Ukraine: Russia say dem go comot some of dia troops for di kontri border

A Ukrainian serviceman points a machine gun through an opening in a sandbag bunker during military exercises

Getty Images
Ukrainian soldiers and police don do different typ exercises for recent times

Russia don gree say dem go commot some of di ova 100,000 troops wey dem bin pack put for Ukraine borders.

But Ukraine foreign minister no wan hear am. E say, “we get rule, you no dey believe wetin we hear, na wetin you see you believe”.

Dis na as im add say make Russia comot all dia remaining forces wey dey outside Ukraine border.

American and UK leaders bin reveal say hope neva finish for solution to di Ukraine kasala to end without war although di mata still get k-leg.

Inside one 40 minute call, Joe Biden and Boris Johnson bin gree say deal still dey possible even though warning dey ground say Russia fit carry out military action soon.

Russia don deny say dem get any plans to enta attack Ukraine even though dem don pack pass 100,000 sojas put for dia border.

Germany Chancellor Olaf Scholz suppose meet with Russia President Vladmir Putin on Tuesday 15 February, afta im meeting with Ukraine President for Kyiv.

For di Monday meeting, e bin say reason no dey for Russian troops to dey dia border.

Dis na even as US Officials don say 16 February na di day wey Russia fit attack, but President Volodymyr Zelensky declare di day say na “day of unity.

E tok say “we get something to respond with, we get ogbonge army, wey strong pass wetin e be eight years ago”.

Dis na as e add say e go like solve all di issues with diplomacy and negotiations.

Ukraine bin don call on Russia and oda membas of one European security group so dem go calm di growing kasala for dia borders.

Ukraine Foreign Minister Dmytro Kuleba bin also reveal say Russia bin no gree ansa formal request as to why dia sojas gada for dia border.

E say di next step na to ask for meeting between di next 48 hours about Russia plan for “transparency”.

Earlier on, some Western kontris bin warn say Russia dey prepare for military action, even as America say Moscow fit start air strikes “at any time”.

More dan 12 kontris bin ginger make dia citizens comot from Ukraine even as some don comot dia embassy staff from di kontri capital, Kyiv.

CBS News tori pipo tok say America dey plan to comot all dia staff from Kyiv in di ‘next 48 hours.’

Oga Kubela tok say Ukraine don ask for ansa on top wetin dem dey plan since Friday, under di rules of di Vienna Document, wey be agreement on top security mata by di members of di Organisation for Security and Cooperation in Europe (OSCE) wey Russia dey inside.

map

BBC

But Ukraine President Volodymyr Zelensky wey criticise di panic wey fit spread ontop claims say attack go hapun, say e neva see any proof say Russia dey plan to attack dem.

On Sunday, e follow American President Joe Biden tok for one hour wia Biden promise say dem go support Ukraine and even sef President Zelensky say make Biden come visit Ukraine, howeva di White House neva comment on top di mata.

President Biden one hour call with Russia leader Vladimir Putin too earlier on bin no go anywia.

UK Prime Minister Boris Johnson too bin plan to do fresh diplomatic toks across Europe so Russia go “come back from di brink” of war.

For America, di National Security Adviser Jake Sullivan bin say invasion fit start “any day now” and dem dey watch out to see how e go.

Russia howeva bin say dia troops for Ukraine border na dia business as e still dey for dia own territory, On Sunday, senior foreign policy official Yuri Ushakov say di US warning of attack no get head.