Building collapse in Yaba Lagos: Authorities recover three deadi bodi of pipo wey trap under di remains, arrest developer of di property

Foto from di building collapse site

BBC

Lagos State Emergency Management Agency confam say three pipo die and dem rescue two odas from di three storey building wey collapse for Yaba area of di state on Saturday.

Di three storey building wey bin dey under construction collapse around 3:00pm on Saturday, 12, February.

E no dey clear wetin cause di building to collapse but Lagos state goment say dem don arrest di developer.

Late arrival of excavator bin make pipo join hands with di rescue officials to begin dey desperate dey use shovel and hammer to take try dig out di remains of di building to rescue pipo.

Di arrival of di excavator for evening make di work faster.

Officials and eyewitnesses dey use hammer, shovel to remove stones and di remains of di building to rescue pipo wey trap

BBC
Officials and eyewitnesses dey use hammer, shovel to remove stones and di remains of di building to rescue pipo wey trap

‘Noise from under’

Eyewitnesses bin tell BBC Pidgin say pipo bin dey inside di building wen e collapse.

The officials bin also try call out di name of pesin wey trap inside to try know wia dem dey to focus effort dia.

One eyewitness dia bin tok say dem hear pesin voice.

As at Saturday night, Lasema bin confam say dem recover three dead bodies from di site.

E no clear weda pesin still trap under but dem never officially end di rescue operation.

Scene of di building collapse

BBC
Scene of di building collapse

Latest updates

Authorities don arrest di developer of di building for No. 16 Akanbi Crescent, Onike, Yaba say im break di government seal on di property and violate di stop-work order dem put for di building.

Di Lagos Commissioner for Physical Planning and Urban Development, Dr. Idris Salako, say investigation show say Lagos State Building Control Agency bin don seal-off di site twice for 2021 for non-compliance wit Building Regulations afta dat time, dem abandon di site.

Di Developer later break Government Seal, sneak into di site and re-commence construction without official authorisation, goment tok.

Lagos State Emergency Management Agency, LASEMA say dia Investigation show say construction workers bin dey on site wen di building collapse.

Meanwhile rescue operation still dey ongoing for di site of di collapsed building.

Dis incident dey hapun months afta di 21 storey building collapse for Ikoyi wey kill more dan 30 pipo.

Di building also bin dey under construction.

Di Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu bin declare three days mourning for di state and say make all flags fly at half-mast for public and private buildings.

Sanwo-Olu bin also task one probe panel im set up to reveal how di high-rise building crash for Gerrard Road.

Scene of di building collapse

BBC
Scene of di building collapse
Excavator dem bring to use for di rescue

BBC
Excavator dem bring to use for di rescue