Israel Adesanya win Robert Whittaker: Highlights of UFC 271 fight between The Stlyebender and Reaper

Israel Adesanya don win Robert Whittaker to retain im title as di UFC middleweight champion.

Di two of dem face each oda on Sunday, (by West Africa time) 12, February 2022.

Dis na one of di rematch wey plenti pipo bin don dey wait for for di UFC middleweight category.

See how di fight hapun – Live updates

Round One

Whittaker don arrive.

E wear white and e no smile at all.

E dey fight out of the blue corner.

Israel don dey waka come.

E dey bounce dey come dey ginger imsef.

E wear all black today.

Na im dey fight out of the red corner.

Dis fight dey happen for the Toyota Centre for Houston inside America.

Israel don go meet officials wet dey check im gloves and im body – as e dey enta di octagon now.

Announcer wan begin call di fight – Israel na 32 years Whittaker na 31 years.

Bruce di announcer don hold mic as e dey call d main event for dis morning.

Ref dey remind dem of di rules as dem touch gloves.Round one don start.

Dem dey move around dey shakara each oda.

First minute don finish and no contact yet from dem two.

E remain 3 mins 30 seconds for dis round.

E remain Three mins 30 seconds for dis round.

Whittaker land leg kick and Adesanya land jab plus kick.

Adesanya land kick.

Adesanya kick Whittaker for leg.

Adesanya don knock Whittaker down but Whittaker jump up sharp sharp.

Na one minute remain for round one.

Whittaker jump in and try grab Adesanya leg but notin happun.

Round one don finish.

Israel and Robert dey exchange blows

Getty Images
Israel and Robert dey exchange blows

Round Two

Whittaker coaches dey tell am say make e punch straight make e no swing again.

Na straight left jab Adesanya take knock am down for round one.

Round two don start.

Whittaker throw kick but Adesanya dey dodge am well well.

Whittaker don start dey box more – but im neva land straight shot.

Whittaker don land jab and Adesanya move back.

Whittaker don land left shot for Adesanya face.

Whittaker grab Adesanya take am down but Adesanya don stand up.

Adesanya don land left kick.

Adesanya land jab – Whittaker land kick.

Na one minute remain for round two.

Adesanya don land di left leg again.

We dey di last 10 seconds.

Round two don finish.

Whittaker right eye don cut.

Adesanya and Whittaker during dia fight

Getty Images
Robert Whittaker of Australia try to take down Israel Adesanya of Nigeria for dia UFC middleweight championship fight during di UFC 271

Round Three

Round three don start.

Both men dey miss dia shots.

Both men don land jab for each oda face.

Adesanya grab Whittaker for neck and dem bend but Whittaker don pull out.

Adesanya don make mistake with im kick and Whittaker use am to do take down but dem don free each oda now,

E be like say Adesanya fit don injure for im left hand.

Na 20 secs remain for dis round.

Whittaker land jab.

Round three don finish.

Dem no attend to Adesanya hand for im corner so e be like say e no too injure for im hand.

Whittaker coaches dey tell am make im go for knock down.

Round Four

Round four don start.

Adesanya land body kick.

Adesanya continue dey kick Whittaker for left leg.

Whittaker jump ontop Adesanya but Adesanya manage open di lock drop am.

Na two minutes remain for dis round.

Both men land jabs.

Adesanya don lock Whittaker hand but e no throw any strike.

Round four don finish.

Whittaker coach don dey ask am to thron im right hand say na only left e don use for di whole fight.

Round Five

Round five don start.

Double jab for Whittaker.

Adesanya dey throw quick kicks from distance.

Whittaker land jabs.

Whittaker wan do take down but Adesanya defend well.

Referee don call for time make Whittaker rest small.

Dem don resume.

Na two minutes remain for dis round and na di final round.

Whittaker attempt take down but Adesanya defend well.

Both men lock for corner.

Whittaker land jab.

Na one minute remain for di total fight.

Na 30 seconds remain.

Fight don finish.

Both men hug and dem finish di fight.

Adesanya even raise Whittaker hand afta both men tok.

Na four take downs Whittaker get for dis fight.

Bruce wan announce di result – 48 47 48 47 49 46 and still………………….

Adesanya don win.

Adesanya say e no get any problem wit im hand but na part of im strategy to distract Whittaker.

Whittaker say e tink say e do enuf to win and e do im best and e tink say e win di fight.

Whittaker say di result surprise am.

More about di fight

Di fight, wey be di main event of UFC 271 hapun for di Toyota Center for Houston, Texas.

Di first time di two bin meet nearly three years ago for Middleweight division, Adesanya bin knock Whittaker out.

Dem meet for di first time for UFC 243 for October 2019, wen Adesanya knock out Whittaker for di second round. Adesanya na di current middleweight champ and don dominate di division since im win di belt.

Before now, Adesanya bin don win 21 of im fights while Whittaker bin don win 24.

Wit dis win, Adesanya don win a total of 22 of im fights.

Adesanya don lose once while Whittaker don lose five times. Both of dem never draw.

Israel Adesanya and Robert Whittaker

Getty Images

Who else bin dey di main card?

Di UFC 271 co-main event feature heavyweight fight between Derrick Lewis vs. Tai Tuivasa.

Middleweight fight between Jared Cannonier vs. Derek Brunson, bantamweight matchup between Kyler Phillips vs. Marcelo Rojo and lightweight fight between Bobby Green vs. Nasrat Haqparast.