Ayo Makun: AY Comedian and wife Mabel born dia second pikin afta 13 years

Nigeria comedian and feem maker, Richard Ayodeji Makun, wey pipo sabi as AY Comedian and im wife, Mabel don born dia second pikin.

Di comedian na im announce di tori for social media say dem born 13 years afta dia first child Michelle.

E reveal dis for video say di pikin na girl pikin.

https://www.instagram.com/tv/CY4jxeoISDw/?utm_source=ig_web_copy_link

E tok say, “Ayomide, thank you say you make Mabel and I, mama and papa again. Thank you say you make Michelle to be big sister.”

AY and im wife bin marry for 2008 and get one pikin wey be 12 years, Michelle Makun.

Who be AY Makun?

AY Makun na comedian wey blow for di industry wit di release of im stand-up comedy show wey im call AY Live wey start for 2010.

AY also get TV drama series like AY’s Crib and The AY Show.

Howeva no be until 2015 e start to dey produce im own feem with 30 Days in Atlanta.

Oda feems wey e don produce include 10 Days in Sun City, A Trip to Jamaica and Merry Men.

E don follow plenti celebs work including Ramsey Nouah, Funke Akindele, Jim Iyke and international stars like Vivica Fox.