Electoral Act Amendment Bill: Nigeria lawmakers don set dia ansa to President Buhari refusal to assent bill wey go reform elections

Speaker of House of Rep, Femi Gbajabiamila, on Tuesday assure Nigerians say di parliament go decide di fate of the Electoral Act (Amendment) Bill 2021 for January next year wen dem return from Christmas and New Year break.Gbajabiamila give di assurance as e deliver im end of the year speech shortly afta e read President communication to di House wia e cite reasons why e no sign di bill into law.

President Buhari bin say di biggest reason e ni sign di bill na bicos of financial implications for di kontri.Oga Gbajabiamila say dem no go throw way di bill just bicos di president no sign sake of di direct primary clause.E come yan say make pipo expect di parliament to do di needful and dem go do dia duty to God and for kontri and dat di lawmakers no go throw out di “baby wit di bath water” and must deliver credible and enduring electoral system to Naija pipo dem.

Nigeria President Muhammadu Buhari explain give di National Assembly di reason why im no gree assent di Electoral Act Amendment Bill.

On Tuesday, 21 December, di Senate and House of Representatives read di president letter wia im give im reason why e no assent to di bill.

For di letter, oga Buhari say na di primaries clause cause am to take di decision.

Di clause according to di president, go cause plenty wahala like di costing moni to do direct primaries.

And according to am, dat costing moni go increase di federal goment financial wahala becos dem dey expensive to conduct.

E add say apart from di plenty moni wey dey involved, direct primaries no go allow small parties to shine.

Di final reason wey di president give be security. E follow say di mata of security na mata wey concin voters as na dem go gada plenti for one place sake of dis kain of election.

Las las di president leave di decision on di best way to pick candidates dey for di hand of di political parties.

E follow say im position on di Electoral Act Amendment Bill na based on careful review plus consultation.

Before di Senate read di president letter, dem first enta close door session to discuss wetin dey inside.

Na afta di close door session, di Senate President Ahmed Lawan explain di president reason.