Buhari in Lagos: President Muhammadu Buhari commission made-in-Nigeria Navy vessels for Victoria Island

Nigeria President Muhammadu Buhari show for Lagos state, di kontri commercial capital on Thursday, 9, December, 2021 to commission some projects of di Nigerian Navy.

Di projects include some new warships and boats for di Naval Dockyard Victoria Island.

Earlier on, di Lagos state Transport Management Authority, LASTMA, bin advise pipo to avoid Ahmadu Bello way sake of di mata.

Among oda instructions, LASTMA bin say make pipo avoid Ahmadu Bello Way, from Adeola Odeku Intersection to Adetokunbo Ademola by Eko Hotels Roundabout as e go dey temporarily closed to traffic and traffic go dey diverted to Adeola Odeku, Akin Adesola to connect your destination.

Some of di boats Buhari commission

BBC
Some of di boats Buhari commission

Meanwhile our reporter on ground bin report say security dey beefed up for Lagos state and di area sake of di visit of Mr president.

Police, Army, officers of di Department of States Services (DSS) Nigerian Airforce and Navy officers full ground especially for Victoria Island, di president destination.

Some of di boats Buhari commission

BBC
Some of di boats Buhari commission

Wetin Buhari tok?

President Buhari say di new warship wey dem just add to di Naval fleet go boost dia ability to secure Nigeria maritime domain.

Buhari tok as e inaugurate di Seaward Defence Boat (SDB) III, wey di Nigerian Navy build.

Di president say di locally constructed SDB, NNS Oji, be di third of im series wey dem go locally build for di Naval Dockyard Limited by only Navy engineers.

Dis na afta di success tori of NNS Adoni, and NNS Karaduwa, wey im commission for 2016.

E charge all di naval personnel to maintain professionalism and ensure good use of di new and recently acquired platforms including NNS LANA, KANO, IKENNE, ABA, SOKOTO and OSUN.

”We suppose know say na critical period we dey now where our kontri dey face serious decline for revenue and di security gbege wey we dey face.

Some of di boats Buhari commission

BBC
Some of di boats Buhari commission

”Di present realities, call for beta resource management, innovativeness, accountability and careful maintenance.

”I wish to repeat say despite dis challenges, our administration dey very determined to ensure say we support di Navy wella so dem go fit achieve.” Buhari tok.

According to Buhari, sake of di present high dependence on oil and gas revenues, di Navy na one major contributor to di economic well-being of Nigeria.

”Arrests of those wey get hand for illegalities don yield results as some pirates, illegal bunkering group, pipeline vandals and oda miscreants don dey convicted dis year.

Dis kind successes dey possible through di enforcement of our new anti-piracy law on Suppression of Piracy and oda Maritime Offences Act 2019.” E add.