
Di trial of di leader of di indigenous people of Biafra go continue for Abuja on Thursday, 2, December, 2021.
Lawyer to Nnamdi Kanu Alloy Ejimakor confam am to BBC Pidgin.
Kanu wey dey detention dey face accuse by Nigerian goment wey say im want secession and also say im dey broadcast lies about President Muhammadu Buhari.
Dem also accuse am say e be member of group wey goment don outlaw. Most of di accuse dey based on di tins wey im allegedly tok for Radio Biafra wey dey broadcast from outside Nigeria.
Di last time e show for court for November 10, court bin adjourn im case till 19th January afta im lawyers stage a walk out.
Ordinarily court session dey start around 9 am local time and dis case go likely start around 9-10 am.
Dis move dey come afta some lgbo leaders bin pay visit to President Muhammadu Buhari on top Kanu case.
Di group wey visit president Buhari na di highly respected Igbo Greats. Di leader of di group na Chief Mbazulike Amaechi.
Di 93-year-old statesman na first Republic parliamentarian and Minister of Aviation.
- See why Akuapem Poloo dey go back to jail
- Usifo Ataga deadi bodi get multiple stab wounds wen we find am for mortuary on im birthday – Witness
Oda pipo for di group wey visit di president na former Governor of Anambra State, Chukwuemeka Ezeife, Bishop Sunday Onuoha of di Methodist Church, Chief Barrister Goddy Uwazurike, former President of Igbo socio-cultural group, Aka Ikenga, and Tagbo Mbazulike Amaechi.
Na Chief Amaechi speak on behalf of di group wia im tok say im no dey happy wit wetin dey happen for South Eastern Nigeria.
E bin beg di president to consider political solution for Kanu mata.
“I promise you say e no go tok anyhow again,” di leader of di group tok.
Buhari for im response say; “I go consider am,”
Di president say im neva ever chook mouth for wetin Judiciary dey do. Dat na why di request of di Igbo leaders go hard am to do.
‘Report wey say Kanu go dey free na assumption’
Kanu lawyer, Ejimakor wey speak to BBC Pidgin explain say Thursday appearance by di Ipob leader na to hear im application for bail.
Ejimakor say im dey surprised by reports wey dey speculate say di court go free Kanu.
“Those reports wey say Kanu go dey free dey unprofessional,” Ejimakor tok.
“Di hearing never hold and dis reports wey dey pre-empt di court dey unprofessional, wetin go happun tomorrow no dey different from wetin we don do before.
“So to stay here and make assumptions say di court go go left or right dey premature”.