Justice Mary Odili: Peter Odili wife Abuja home invasion, Malami, EFCC, DSS deny, NBA seek justice

Di Nigeria Bar Association (NBA) don chook ontop wetin dem describe as di ‘unlawful siege’ of di house of di colleague, Justice Mary Odili for Abuja by some security forces.

Dem tok say even as 24 hours don almost reach ontop di mata, di complete gist about who get hand inside neva comot.

Di president of di NBA, Olumide Akpata SAN tok dis one for inside statement wey di association release as e follow add say di raid dey remind dem of dis same kain tin wey happen for 2016.

‘In case law enforcement agencies neva learn dia lesson, events like dis na im dey reduce di independence of sacred democratic institutions like di Judiciary, undermine di rule of law for Nigeria and dey reduce pipo confidence in Nigeria…”

Akpata follow tok say im go lead delegation go see di minister of justice, Abubakar Malami and heads of security agencies to find true-true wetin really happen.

Kanu Lawyer reply Malami over fresh accuse
The British Broadcasting Corporation

Meanwhile, Abubakar Malami, Nigeria Minister of Justice say im no dey involved for Justice Mary Odili Abuja home invasion.

Malami say make dem count am out, and say im gatz clear di mata sake of di dimension wey di story don dey take

Di Attorney General of di Federation media assistant Umar Jibrilu Gwandu na im clear di mata inside statement on Saturday, hours afta di incident.

E dey important to set di record straight say as di Chief Law Officer of di Federation, Malami no go bend so low to be associated with yeye court process wey dem use obtain di search warrant. Di statement tok.

Malami add say di general public need to know say nothing dey wey dem dey call “Joint Panel Recovery Under di Ministry of Justice” inside di Office of the Attorney General of di Federation and Minister of Justice.

Him add say even by extension nothing like dat dey di entire Federal Ministry of Justice.

Wetin we get na Inter-Ministerial Committee on Assets Recovery” wey get di mandate but e no include stings operations. Na wetin di minister note.

Di Justice Minister say di documents wey dey in circulation on top dis mata reveal traces of criminal actions which particular regards to:

1. Di name as contained on di purported letter headed paper “Ghost’s Account For Local Whistle Blowers & Assets Tax Recovery Panel”,

2. Di ambiguous reference to “Ministry of Justice” without clarifying as to whether na Federal or State Ministry and of which State,

3. Di claimed office address which as e dey revealed by di letter headed paper no be di address of di Federal Ministry of Justice

4. Email address used on di letter

‘None of our operatives storm Mary Odili domot for Maitama Abuja’, na wetin Nigeria corruption police – EFCC tok.

Nigeria secret police – Department of State Service [DSS] don also deny involvement inside dis case.

Di statement add say di office of di Chief Law officer alias Attorney General don since reach out to relevant authorities for serious wider investigation on di matter.

Dis na for necessary actions leading to di prosecution of anyone involved for di matter.

Dis na in view of di fact say di only names on record from di process wey dey filed in court dey believed to be police officer wey claim to be “O/C Assets Recovery Team” and one Aliyu Umar wey sign di affidavit.

Justice Mary Odili house invasion – How e happun

Justice Mary Odili house for Abuja witness security operatives wey storm dia domot to search di place.

Friday evening incident don cause serious concern as e be say Mary Odili na Justice of di supreme court.

Di mata serious sotay Rivers State Govnor Nyesom Wike togeda wit some close friends of di Odilis like Abiye Sekibo and Raymond Dokpesi visit di house to check on dem.

Tori be say for some time now Justice Mary Odili husband Peter Odili, a former Governor of Rivers State dey face fresh kwanta wit authorities.

And e no dey clear who, between di wife Justice Mary and di husband Sir Peter Odili, be di target of di security agents wey storm di apartment.

One local report say di security operatives, wey storm di residence on Friday, say dem receive information on “illegal activities” wey dey go on inside di house.

Mary Odili be one of di most senior Supreme Court Justices of di Federal Republic of Nigeria.

She be one of those in line to succeed di current Chief Justice of Nigeria.

BBC Pidgin don see document wey one one Aliyu Ibrahim on October 13 sign affidavit stating;

Say im don “observe some illegal activities going on in some houses within Abuja and its environs”.

Based on dis, one Lawrence Ajodo, wey identify as a chief superintendent of police go collect warrant to carry out a search.

Ajodo dey believed to be a member of di investigation team under di asset tax recovery panel of Nigeria Ministry of Justice.

On Friday, Emmanuel Iyanna, a chief magistrate for Wuse zone 6 magistrate court grant di warrant, according to wetin BBC Pidgin find out.

Di application na for search warrant to fit use cari out investigation at No. 9, Imo street, Maitama, FCT, Abuja,” according to tori.

But di address for di warrant dem obtain no be dat of Justice Mary Odili.

While Odili address na 7, Imo river street, Maitama, di address on di warrant document na 9, Imo street, Maitama.

See di affidavit, di Court Order, di Complainant, Magistrate and Police officer wey allow di invasion of Justice Odili House

Police neva tok peem on wetin dia operatives go find for Justice Mary Odili domot.

Justice Mary Odili: Chief Magistrate Emmanuel Iyanna reportedly revoke search warrant

On Saturday morning local media begin report say di Chief Magistrate Emmanuel Iyanna of Wuse Zone 6 magisterial division in Abuja don revoke di search warrant im approve.

Although BBC Pidgin neva see evidence of di revocation, reports say di Chief Magistrate allegedly admit say dem lie to am into signing a search warrant.

Mr Iyanna reported action na due to misrepresentation in di first information application wey di applicant of di search warrant bin give.

Document show say na di ad-hoc public asset recovery panel under di justice ministry na im obtain di search warrant.

E no dey clear wia Peter Odili bin dey wen di incident happun.

Speaking to journalists for dia domot on Friday, Mike Ozekhome, lawyer to Odili, describe di warrant as one wit “fundamental flaws”.

BBC Pidgin find out say security agents show up at for di residence around 5pm.

But dem prevent dem from accessing di property by a team of security officials wey dey stationed for di house.

Security agents wey go di Maitama Abuja domot of di Supreme Court judge bin tanda dia for about five hours on Friday evening.

Tori be say under Nigeria separation of powers, e no too pure for a Supreme Court to get dis kain treatment as e be say di Judiciary dey independent of di Executive.

And dis no be first time wey security operatives go storm domot of Nigerian Judges to cari out search warrant.

Anti-corruption fight na one of di top agenda of President Muhammadu Buhari goment.

But weda dis lastest invasion on Justice Mary Odili official residence na new chapter of di anti corruption drive, eyes still dey watch.