PSG vs Man City: Lionel Messi end ‘desperate’ search for goal against Man City

Lionel Messi

Getty Images
Lionel Messi goal na e first for club level since im final Barcelona game, wey be 2-1 defeat against Celta Vigo for May

Na di moment European football bin dey wait for – and di one Pep Guardiola know say e go dey “unstoppable”.

Lionel Messi run forward from di halfway line late on against Manchester City for di Parc des Princes, im play one-two wit Paris St-Germain team-mate Kylian Mbappe before im shot leave goalkeeper Ederson helpless as e go straight to di top corner.

Dis na e first club goal for e entire career wey no be for Barcelona and e seal 2-0 victory for di team wey sign am to lead dem to Champions League glory.

Di goal end run of 264 minutes without a goal for Messi since e move from Spain.

“Na true say I bin don begin feel desperate to score my first goal,” Messi tell French tori pipo Canal Plus. “I never play much recently and I bin don only play once here at home but I dey settle into di team small small.

“Di more us forwards play together, di better our relationship go be. We all need to grow together and improve and continue to give our best.”

Lionel Messi

EPA
Messi scored wit e only shot of di game against Manchester City

E take di 34-year-old Argentine more than one month to play e first four games for e new club because of lack of fitness, Internal duty and den injury.

Im bin don fail to score for e first three fixtures for PSG – against Reims, Club Brugges and Lyon – afta e join on free transfer last summer.

By im standards di goals bin don dry up.

PSG boss Pochettino, bin dey happy to di goal drought end. “Usually I no dey celebrate goals, I keep to myself,” Im tok. “But today, for Messi, I did.

“I spend years dey watch Messi score goals from di opponent’s side – so dis time, to score for my team, e dey great.”

Guardiola win two Champions Leagues and three Spanish titles with Messi but im bin dey unable to ensure e side stop one of di greats for di game.

“We know e dey impossible to control Leo during 90 minutes,” im tok.

“Im bin no really dey in touch with di ball – of course im just dey come back from injury, im need a bit of rhythm – but we know quite well wen e fit run and get close to di ball, im dey unstoppable.”