WAEC Maths questions and answers: WAEC reveal 2021 WASSCE General Mathematics paper leak

West Africa Examination Council [WAEC] don threaten to take action against schools wey get hand for examination malpractice across Ghana.

WAEC say dem discover General Mathematics and English Language papers leak on social media.

“Cheating” social media groups be dey in full swing prior to de conduct of de Mathematics (Elective) and English Language Papers on 9th and 13th September, 2021 respectively.” WAEC confam am for statement.

De council give names of 11 schools wey allegedly involve for some of de examination malpractices, say dem dey on dia watch list.

Dem also mention de names of di alleged ‘rogue’ websites wey circulate several versions of de questions on social media.

Although WAEC say reports from dia investigation and further information demma receive show say de circulation no be too dey extensive.

But de next line of action be to punish alias sanction all de pipo wey dem find culpable [those wey dey involved].

WAEC 2021 Maths expo: See WAEC next line of action

De exam body don promise to prosecute operatives of de fraudulent groups wey get hand for de exam expo and facilitate dia punishment.

Also, WAEC go send various internationally accepted assessment procedures and interventions within dia domain to guarantee de credibility of results.

Dem don also tok say demma sanction all de students and groups wey involve for de cheating.

Dem ask parents, religious leaders and well-meaning people for society to advice dia children to stay away from de social media group wey dey involve and also focus on dia books.

WAEC wan increase inspection and monitoring for de following centres wey dem don mark sake of tip offs on intentions to cheat.

Dis be de schools on dia watch list in Ghana

  • Ejisu Senior High Technical School
  • Anlo-Afiadenyigba Senior High School,
  • Tepa Senior High School
  • Yeji Senior High Technical School
  • King David College, Somanya
  • Ideal College, Sunyani
  • Christ the King Senior High School, Obuasi
  • Modern Senior High School, Kpong
  • Modern Senior High School, Kintampo
  • Oyoko Methodist Senior High School
  • Klo Agogo Senior High School

WAEC 2021 Maths expo: See de social media platforms wia WAEC see di leaked papers

De exam body say di activities of social media cartels i.e rogue websites, WhatsApp/Telegram groups dey in full force wit several versions of di questions wey dem dey circulate on social media platforms.

Some of de groups na; Ruth, Jerusalema, Eminent Link, Mr. Robert, Success Room, Mr. IUPAC, Brotherhood and WAEC Secret Helper.

WAEC say dia investigative team dey track dis websites /WhatsApp/Telegram groups and dem don discover how dem dey operate.

De council to also scrutinize scripts of schools wia dem don report cheating.

Dema withdraw some supervisors and invigilators from providing services for de Council pending further sanctioning.

And finally continue to dey track rogue websites and social media cartels in collaboration wit security agencies.

Apart from de exam irregularities wey WAEC don record for Ghana, di council don however hail de smooth running of de exams since e start on 16 August.