Jimmy Greaves death: European football react to death of Tottenham highest goalscorer

Jimmy Greaves death: European football react to death of Tottenham highest goalscorer

Getty Images
Jimmy Greaves

Former England Striker and Tottenham highest goalscorer Jimmy Greaves don die at di age of 81.

Di club confam dis one for statement say;

“We dey very pained to hear say di ogbonge Jimmy Greaves don die.

“As e no be only Tottenham Hotspur record goalscorer but also di finest marksman wey dis kontri don [England] ever see”.

Oda pipo wey follow mourn di late footballer na British Prime Minister, Boris Johnson wey call am “goalscoring legend”.

Tottenham captain Gary Mabbut praise im playing skills and sense of humour.

Uefa hail oga Greaves on top how im bin help Tottenham to become di first ever English club to carry Uefa trophy.

West Ham do one minute clapping for Jimmy Greaves before dia match against Manchester United on Sunday.

Who be Jimmy Greaves?

  • Jimmy Greaves get di record of most goals in one season for Chelsea afta in score 41 goals for 1960-61.
  • E also get di same record for Spurs for im goals for di 1962-63 season
  • E score 44 goals for England in 57 games and bin dey part of di squad wey win di 1966 World Cup.
  • For im club career im don play for chelsea, AC Milan, Spurs and West Ham.
  • Greaves na di fourth all time England highest goalscorer behind Wayne Rooney, Sir Bobby Charlton and Gary Lineker.
  • E don suffer two strokes for im life, one mior one for 2012 and one severe one 2015.