Switzerland vs Spain: Yann Sommer heroics no dey enough as Spain defeat Switzerland 3-1 on penalties

Spain

Getty Images

Spain don become di first kontri to qualify for di semi-final of Euro 2020 as dem defeat Switzerland 3-1 on penalties.

Di match bin end 1-1 for regulation time as both teams bin cancel demselves out afta 120 minutes.

Spain bin take di lead afta eight minutes for di first half when Jordi Alba shot touch Denis Zakaria come deflect past di Swiss goalkeeper.

But Xherdan Shaqiri equalise for di Swiss for di second half as im score from Remo Freuler assist.

Di Swiss bin finish di game with 10-men as Freuler collect straight red card for di 77th minute.

Dis result mean say Spain go play either Belgium or Italy for semi final.

Die hard Swiss fall short for penalty shootout

Afta dia surprise victory over France for di last round, Switzerland bin come into dis match as di underdogs.

E no take long for dem to fall behind early on in di game as Zakaria wey replace di suspended Granit Xhaka deflect Alba shot past di impressive Sommer.

But like di France game, dem battle dia way back into di tie wit Shaqiri goal for di 66th minute.

Di Swiss show fight and spirit despite say dem finish di match wit 10-men. Dia goalkeeper Yann Sommer bin dey in outstanding form as e pull several stops to deny Spain.

But na during di shootout di Swiss fall dia hand as Schar, Akanji and Vargas all miss dia penalty kicks.