“Gabon” be 1st African nation paid by ‘Cafi for protecting dia rainforest’

Getty Images
Gabon Forest Elephant

Gabon be first in Africa to collect money for protecting dia rainforest.

Dia reward na $17 million for reducing carbon emissions as dem protect di rainforest.

Di Central African nation also cut down deforestation and forest degradation for dis.

Di payment land “after independent experts verified Gabon results”.

Di results show say di kontri carbon emissions in 2016-17 drop from 2006-15 figures.

United Nations backed Central African Forest Initiative (Cafi), na im deliver di money.

Cafi na organization wey launch in 2015 wit support from international donors.

Dis na di first part of a $150m wey dem reach for 2019.

Nearly 90% of Gabon be forest wey dey catch more carbon.

Rainforests dey very important to absorb di carbon wey dey make d world hot.

Norway pass through Cafi to dash Gabon $17m based on formula wey dem calculate.

Di formula measure di amount of carbon wey for comot if dem no make di steps.

Dem go share di remaining $150m ova di coming years.

Dis 17 million na just 0.1% of Gabon yearly GDP.

But di Forest Minister Lee White tell BBC say say na beta first step.

White say, Norway don give dem beta gbosa for di way Gabon bin dey treat dis mata.

Dis mean say dem go fit start to collect money from kontris wey dey create carbons.

So dat dem go fit manage dia resources for future.

How Gabon take make $17m from Carbon Emission Control?

Getty Images
About 90% of Gabon na forest full am

Gabon don start some programmes on conservation ova di last few years.

Dem create 13 national parks and one project to fight illegal logging in di programmes.

But di kontri too say dem still wan dey make money from Timber join.

So dem go continue to dey harvest more trees.

Dis don make some critics to hala say dis fit be PR stunt.

Data from di Global Forest watch say 2017 na dia highest rate of forest loss since 2001.

Howeva, Gabon dey put leg for ground say, wetin dem monitor show say dem go fit to maintain dia low carbon emissions from wetin dem call sustainable forestry.