‘Unknown gunmen’ attack Delta police station, kill three officers for Aniocha South

BBC
Nowadays unknown gunmen attack on Police Stations dey happun anyhow.

Three Police officers die as unknown gunmen attack Nsukwa Divisional Police Station for Aniocha South.

Delta State Police Command don confam di Sunday morning attack to to BBC Pidgin.

Police tok tok pesin Bright Edafe say fi officers lost dia lives wen di gunmen set di police station on fire.

E add say dem don restore calm to di area even as dem don begin investigation into di matter.

Nowadays unknown gunmen attack on Police Stations dey happun anyhow.

President Muhammdu Buhari don come under fire sake of di growing insecurity across Nigeria.

Just before di Eid holidays govnors from all southern states hold meeting for Asaba, di Delta State capital.

For dat security meeting dem ask di president to address di nation ontop all dis ‘Unknown gunmen’ attacks.

We go dey bring una more details later.