Curfew in Rivers State: Nyesom Wike declare 8-hour curfew across all 23 LGAs

Rivers State Goment don impose State wide dusk to dawn curfew wit immediate effect.

Di new movement restriction affect all di 23 local goment areas of di state.

Di govnor make dis announcement for state-wide TV broadcast on Thursday.

No movement from 10pm to 6am beginning form today 29 April, 2021 until further notice, Wike tok.

Dis dey come after di State Executive Council discuss di matter.

Dem goment also review di state of security after recent attacks on security personnel for Ikwerre and Abua/Odual.

Dis new order from di govnor means say no more late night waka inside di oil rich state for Niger Delta region.

Di state chief security officer bin ban entry and exit from di state from 8pm to 6am on Tuesday 27 April, 2021.

Dat ban take effect di next day, 28 April, before dis latest curfew all over di southern Nigerian state.

Curfew in Rivers State: How e affect you?

Wetin dis latest curfew mean be say evri pesin wey dey live for di State weda for city or for village suppose dey im house before time reach 10pm.

And dem fit begin waka again for morning by 6am.

For business pipo too, dis new curfew mean say dem suppose close shop and reach dia house before time reach 10pm.

For pesin wey dey outside Rivers State and e dey plan to come in, make sure e enter di State before 8pm

And reach house before 10pm sake of di curfew.

Dis movement restriction also affect di waterways.

No human or vehicular movement dey allowed within di period of di curfew.

Governor Wike say di State Executive Council take dis measures to secure di State

And guarantee di protection of lives and property of pipo wey dey live and do business for di State, im tok.

Earlier dis week di Govnor of Rivers State, Nyesom Wike, say di present insecurity and unchallenged killings of citizens across Nigeria na clear bad leadership.

And sake of dat, di govnor say Nigeria don collapse.

Di number one citizen of di oil rich Nigerian state tok dis one on Tuesday for Goment House Port Harcourt.

Wike add say, leaders no dey bold to speak against di bad tins wey dey happen for di land.

Di state govnor add say instead of Nigerian leaders to sincerely pursue solutions, dem dey pretend say everitin dey okay.

“Nigeria don totally collapsed. Look at wetin happen for Nasarawa and Benue States, how dem slaughter pipo on di road.

“See wetin dey happen for Niger State and di APC Governor dia dey cry, say im don dey tok to Federal Goment.

“But nobody dey listen to am and now Boko Haram don come to take over di state, wey be di closest to Abuja.”

Di Chief Security Officer of Rivers State say im bin don raise alarm of di danger of insecurity wey dey come but dem politicised and dismiss di mata.

But, now na di States under di All Progressives Congress (APC) wey be di worst hit. Govnor Wike add.