Oluremi Tinubu, Smart Adeyemi: Profile of Senators wey trend sake of Nigeria insecurity

Senator Smart Adeyemi and Senator Oluremi Tinubu dey trend sake of dia debate on Nigeria insecurity mata for Senate.

Adeyemi, di senator representing Kogi West district, tok from im mind on Tuesday for di red chambers of di National Assembly.

E yan about how di current administration don fail Nigerians in terms of providing security for di pipo.

“Mr. President, insecurity na serious problem today for Nigeria, and time don come when we must tok true irrespective of di sentiments wey we share.

“Today, Mr. President, dem dey threaten all of us – our families, our nation, our state.

“We no fit run from di facts say more than ever before, for di history of our nation, dis na worst insecurity wey we don get since after di civil war.

“If we no get wetin we need to fight insecurity, notin dey wrong if we beg oda kontris to come help us.

“Di President must rise to di occasion to resolve di security challenge for dis kontri. Di nation dey on fire,”

Dis na wetin Smart Adeyemi tok during im debate on top security mata for senate, wey make am even wan shed tears as e dey yan.

Many Nigerians wey watch di video don begin debate about di mata.

https://www.youtube.com/watch?v=C17Ol8iJk5w

Interesting profile of di two Senators wey trend sake of Nigeria insecurity

Who be Senator Smart Adeyemi?

Senator Smart Adeyemi, na a member of di ruling All Progressives Congress (APC) political party,

Di journalist turn senator dey represent Kogi West Senatorial District for National Assembly.

Na him im defeat im main challenger, Senator Dino Melaye of di main opposition PDP party for 2019.

Dis na di third time di oga Adeyemi dey enter Senate after im first attempt for 2007.

Before im enter Senate, him bin hold di position of National President of di Nigerian Union of Journalists between 1999 and 2006.

Di Kogi Senator go school well well as im get post-graduate diploma for Public Relations, diploma for Law.

E also get advanced diploma for Mass Communication, and master’s for Public Administration from Federal University of Technology Owerri.

Senator Adeyemi na sixty years old as dem born am for August, 1960 for Iyara, Ijumu Local Government Area of Kogi State.

Di Kogi Senator don serve for different committees since im join senate.

Dem include: committees on Privatization, Industry, Federal Character & Inter-Government Affairs, Federal Capital Territory.

E also don be member of Senate Appropriation committee.

Pipo sabi Adeyemi as man wey dey tok im mind and im never change even as im dey di ruling party.

Who be Senator Oluremi Tinubu?

Senator Oluremi Tinubu na wife of former Lagos State Governor Bola Ahmed Tinubu wey also be former Senator.

Before Madam Tinubu enter politics she be di First Lady for Lagos where she dey with her husband between 1999 and 2007.

Madam Tinubu na also 60 years as dem born am for September, 1960 for Ogun State.

She go Our lady of apostles secondary school Ijebu-ode, she get PGD from The Redeemed Christian bible college for 2010.

Di Senator also collect B.S. for Education from University of Ife, and National Certificate of Education for Botany and Zoology from Adeyemi College of Education.

Di former First Lady of Lagos na one of di major Senators wey dey advocate for di creation of state police as a way to tackle di cases of insecurity wey don become major problem or di country.

Oluremi Tinubu wey dey represent Lagos Central na member of APC and na third term Senator.

She take her first senate position for 2012 and by 2015 she follow for six oda women wey dey di Upper chamber.

She don occupy position for plenty committees for di Nigerian Senate.

Just recently she propose bill to reform di Nigerian Postal Service (NIPOST) to make am more viable.

Dis no be di first time Senator Tinubu dey get kwanta with oda Senators:

For 2016 she beg for better security from di Inspector-General of Police.

Dat time she allege say Senator Dino Melaye wey represent Kogi West at di time bin plan to assault am.