Chidi Izuwah ICRC: Death of Nigeria Infrastructure Concession Regulatory Commission boss

Di Director-General of di Infrastructure Concession Regulatory Commission, ICRC Chidi Izuwah don die at di age of 55.

Na di acting tok-tok pesin for di Commission, Manji Yarling comot with dis informant.

For statement dem tok say, oga Izuwah bin die afta im bin dey sick for a long time.

Oga Izuwah start to dey work as di DG of di commission for 2019 afta President Muhammadu Buhari bin appoint am.

Who be Chidi Izuwah?

Oga Izuwah bin start im education for di University for Nigeria for Nsukka wia im get im Bachelors for Civil Engineering.

E come specialize in Hydraulic Engineering wen im do im masters for 1987 for di University of Newcastle.

E start im career for Shell wia im bin work as contract manager before im progress Corp Pipeline Manager and then Production Special Projects Consultant wia e bin dey till 2019.

After im don work 20 years for Shell, e come port enta di Infrastructure Concession Regulatory Commission, ICRC as Executive Director for di Public-Private Partnership Resource Department for 2009, and Director, Support Services Department of di commission.

Then for 2019, President Muhammadu Buhari come appoint am as oga of di ICRC.