Covenant University lecturer arrested: How lecturer accused for rape of 17 year old student chop arrest, dismissal from David Oyedepo private university

"Covenant university lecturer arrested"

Getty Images
Na only 18 per cent rape cases dem don convict for Nigeria as at 2015.

Covenant University don dismiss one of dia lecturers on top accuse of rape of a 17 year old student of di school.

Di Nigerian private university wey David Oyedepo, di presiding Bishop of Living Faith Church establish, confam dis to BBC News Pidgin on Wednesday.

Covenant University Registrar, Oluwasegun Omidiora say dem sack alias dismiss di lecturer on Friday 12 March, 2021 sake of say dia school dey against act of rape.

Di 41 years old lecturer chop sack for allegedly raping a 17 year-old-student of di school, according to di Christian university for Ogun State, South West of Nigeria.

Oga Oluwasegun Omidiora say dem don hand am over to di police for further investigation.

Di Ogun State Police Command bin arrest di lecturer on March 11,2021, BBC News Pidgin find out.

On interrogation, di suspect bin admit say im get carnal knowledge of di 17 year-old victim, but im no give reason for im action.

Di arrest of di suspected lecturer, wey be Doctorate degree holder of di Department of Business Management, bin follow one complain wey di parents of di victim bin lodge.

[Covenant University lecturer arrested] – How di student rape happun

Di parent of di victim bin report say dia daughter call dem on phone from di school say her lecturer bin invite her to di office on di said date under di pretence say im bin wan plan a surprise birthday party for her close friend.

According to di report, wen she get to di lecturer office , he lock di office door and forcefully had sex wit her on top of di table for im office.

Di university authority help di police to track, arrest and hand over di lecturer to di police after dem hear of di incident.

Covenant University

Getty Images
Covenant University students like many oda undergraduates in Nigeria, dey spend at least four years to get a degree.

Covenant University, Ota – Ogun State, Nigeria

Covenant University pocket recognition as one of di best university for Nigeria according to “The World University Ranking” for 2018.

Dem dey rank according to Teaching, Research, Citation, Industry Income and International Outlook.

Na for 2002 dem start di school, and to get dis kain accolade no be small sometin. So wetin make dem thick? We tok to some pipo wey graduate from di school to find out.

Di rules of Covenant University na wetin don dey make pipo for outside dey shout say e dey highly restrictive.

Some of di rules na say you must to attend evri school function (weda na class or chapel service) fifteen minutes before di event start.

Di dress code wey be say na only corporate you fit wear go class, and even di number of classes you must to attend to fit write exams (75% attendance for di whole school).

If found guilty, di university lecturer accused of rape fit spend up to 14 years for prison, depending on di number of charges against am.

See wetin dey inside sexual harassment law for Nigeria Universities

  • Any teacher/lecturer wey get sexual intercourse with student or demand for sex from a student or pesin wey wan become student of di school go face up to 14 years for prison or not less dan five years, without fine.
  • Any teacher/lecturer wey intimidate or create hostile or offensive environment for di student as im dey ask for sex from di student or e dey make sexual advances towards di student go face up to 14 years for prison or not less dan five years, without fine.
  • Any teacher/lecturer wey order or force anoda pesin to commit any act of sexual harassment, or e get hand for any sexual harassment act by anoda pesin go face up to 14 years for prison or not less dan 5 years, without fine.
  • Any teacher/lecturer wey grab, hug, kiss, rub or stroke or touch or pinch di breasts or hair or lips or hips or buttocks or any oda sensual part of di body of a student, na up to five years e go spend for jail or e no go less pass two years.
  • Any teacher/lecturer wey display, give or send by hand or courier or electronic or any oda means naked or sexual explicit pictures or videos or sex related objects to any student go spend up to five years jail or e no go less pass two years.
  • Any teacher/lecturer wey whistle or wink at any student or screams or exclaims or joke or make sexual compliment or uncomplimentary tok-tok about any student body or e dey stalk di student, na up to five years e go spend for jail or e no go less pass two years.
  • Any administrative oga wey no gree set up Independent Sexual Harassment Prohibition Committee to investigate Sexual Harassment Complaint wit di permission of di management body of di school go pay fine of N5,000,000 or gbab five years in prison, or both.
  • Any administrative oga wey no gree refer Sexual Harassment Complaint to di Independent Sexual Harassment Prohibition Committee for di institution for proper investigation, go chop minimum fine of N5,000,000 or imprisonment for at least two years, or both.
  • Afta dem investigate any Sexual Harassment Complaint, and dem find say di accuse no dey true, di student fit gbab suspension from di school.
  • Administrative head of institution must make sure say any student wey make Sexual Harassment Complaint dey protected from victimization from di educator wey im accuse and oda teacher/lecturer or pipo within di school and oda schools.
  • Any teacher/lecturer or pesin for di institution wia dem report sexual harassment wey victimize di student wey complain of Sexual Harassment go suffer di same punishment like di wey teacher/lecturer dem bin originally complain against.