NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest ahead of planned strike action

"NLC strike 2021": NLC protest

BBC

Nigeria Labour Congress [NLC] protest dey happun all over Nigeria today ahead of a planned strike action of di goment workers.

Tori be say NLC wey be di umbrella labour union of Nigeria goment workers enta street on Wednesday morning to protest ontop matters wey dey affect dia members like minimum wage and oda tins.

Ayuba Waba, di National President of Nigeria Labour Congress say dem no happy wit how Nigeria lawmakers wan comot minimum wage matter from di exclusive list, put am for di concurrent list.

According to Nigeria law books, to remove something from exclusive list, put am for di concurrent list mean say di resposibility to control dat thing go comot from federal government hand enta state government hand.

Di NLC leader say na sake of dis mata dem dey protest to show say dem no dey comfortable with dat arrangement and if goment no listen to dem, more protest and strike action go happun.

NLC strike 2021: Why NLC protest

BBC
"NLC strike 2021": NLC protest

BBC
NCL protesters for Lagos

NLC strike 2021 and di current Minimum wage

Nigeria goment put workers minimum wage at 30,000 Naira [about $80 USD] a month but plenti state govnors say dem no dey fit pay day amount.

Di legislative arm of goment say na sake of dat make dem wan move di mata to di concurrent list.

Our reporters dey Lagos, Abuja, Kano and Port Harcourt to bring una live update ontop we Facebook channel.

NLC protest photos

"NLC strike 2021": NLC protest

BBC
Police try to stop NLC protest for Lagos ‘Ikeja under bridge’
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
Police no gree make workers enta Lagos State House of Assembly. Workers break down di barricade cross am and now wan break down di gate to access di goment facility. Dem claim say goment facility na pipo facility so dem must enta
"NLC strike 2021": NLC protest

BBC
NLC national president Ayuba Waba lead di protest for Abuja to National Assembly building
"NLC strike 2021": NLC protest

BBC
Nigeria goment workers enta street on Wednesday morning to protest ontop matters wey dey affect dia members like minimum wage and oda tins.
"NLC strike 2021": NLC protest

BBC
NLC protest for Abuja Unity Fountain
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
NLC members for Kano northern Nigeria on Wednesday morning
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
NLC Protest for Kano
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
For Kano, Governor Abdulahi Ganduje already dey pay di 30k minimum wage.
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
Union members begin to gather for Audu Bako Secretariat ahead of 10.30am protest inside Kano metropolis in support of Nigerian workers.
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
Kano, northwest Nigeria
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
Kano
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
Nigeria Labour Congress [NLC] protest inside Port Harcourt Nigeria
NLC strike 2021: Nigeria Labour Congress [NLC] protest

BBC
Nigeria Labour Congress [NLC] members for Oyo State protest go di State House of Assembly for Ibadan

Di last time Nigeria labour unions charge like dis na for September 2020 wen di organised labour and civil society group bin mobilise Nigerians to come out and protest how goment increase fuel and electricity moni.

Dem believe say if dem do am togeda, dem go get beta result and hold goment to do wetin Nigerians want. However goment go court to stop labour, and di leadership of NLC suspend di protest and strike afta dem reach agreement.

Na for October 2018,di Unions reach one agreement with di Nigerian Federal Government on minimum wage of 30,000 naira. But since then many states fail to pay di agreed amount. Dem say dem no get money to pay.