Coronavirus update: African leaders collect vaccine live on TV, as countries begin roll out

Ghana president Nana Akufo-Addo don collect im kontri first dose of di Covid-19 vaccine on Monday, as sign of im leadership but im no be di first African leader to do dis.

Many world leaders dey do dis as dia responsibility to spread confidence say di Covid-19 vaccines dey safe.

For Nigeria, expectations na say President Muhammadu Buhari, go be di first pesin to collect di COVAX programme vaccine wey don land di kontri on Tuesday 2 March.

Dr Faisal Shuaib, wey be di oga of di kontri National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA) say di president go do dis live on TV to encourage Nigerians to take di vaccine.

Even before im presidency dey official, di then US president-elect Joe Biden, on 21 December 2020, collect vaccine live on television to show im kontri pipo and di world say “nothing dey to worry about”.

Officials tanda in front of plane wey carry Nigeria vaccine come

BBC
Nigeria Covid vaccines don land but authorities say dem no fit give date when vaccination go begin

Small time after, oda kontri leaders like Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu and Saudi Arabia Crown Prince Mohammed bin Salman begin.

And African leaders no dey too far behind for dis ‘live on air’ vaccination. Make we see wia who don collect, which type dem collect and wia dia kontri dey wit dia vaccination plan.

Seychelles

President Wavel Ramkalawan make history on 10 January 2021 when e become di first African leader to collect vaccine live for public.

Di Seychelles president take di China-made Sinopharm to mark di start of dia kontri vaccination plan.

South Africa

For one of im kontri most poor township, President Cyril Ramaphosa on 17 February go di Khayelitsha Hospital – wey be public hospital – to collect im vaccine live on television.

Dis way di president use one stone to kill two birds: E demonstrate say di Johnson & Johnson coronavirus vaccine safe and say e dey okay to enter public health facility to collect am. Ramaphosa later tweet say di vaccine injection “dey quick, easy and e no dey pain”.

Zimbabwe

Although no be di president collect di kontri first covid-19 vaccination, president Emmerson Mnangagwa on 18 February say “thank you” to deputy Constantino Chiwenga wey do di honours live on television.

Chiwenga na also di kontri health minister. E no dey clear whether Mnangagwa collect privately later later.

Senegal

President Macky Sall collect di Sinopharm, for di presidential palace on 25 February. Although im no be di first kontri man to collect as di official roll out start two days earlier.

King Mohammed VI dey collect vaccine

Reuters
Morocco, one of Africa biggest konties start dia national vaccination programme

Morocco

King Mohammed VI mark im kontri vaccination program when on 28 February, e collect di first Covid-19 vaccine for di Royal Place.

Di first category of pipo wey go dey vaccinated for di kontri na 75-year-old plus pipo, and health, security, and teaching staff.


Vaccines dey safe?

Di World Health Organisation don maintain say dem no allow companies take any shortcuts for di production of approved vaccines.

For im nationwide address, Akufo-Addo rubbish rumours by some Ghanaians say di vaccines fit change pesin DNA and destroy di African race, Modern Ghana bin report.