Kagara GSC Niger state kidnapped school boys regain freedom

Niger State government don confam report say di Abducted Students, Staff and Relatives of Government Science Collage Kagara don regain dia freedom.

For inside tweet, di Governor of Niger State, Abubakar Bello say im don welcome di students and others for di government house on Saturday.

Jaguda pipo bin kidnap students of di Government Science College Kagara, for Rafi Local Government Area of Niger State one week ago

Dem kidnap about 27 students and 12 other persons from di school.

“Di Kagara schoolboys have been released. dem dey on dia way to town now,” one source also tell local tori pipo.

“Dem don release all di boys and and dia family members.”

Di principal of di GSC Kagara also confam di release of di abducted Students to former Nigerian Senator Shehu Sani, as im tok for twitter.

Dis release of di Kagara students dey come just one day afta jaguda pipo kidnap over 300 schoolgirls from Government Girls Secondary School, Jangebe in Zamfara state.