Plane crash today Abuja: Nigeria Airforce aircraft crash near Nnamdi Azikiwe International Airport afta engine failure report -Eyewitness tok how e happun

One eyewitness don tell BBC Pidgin wetin happun before one military plane crash for Abuja, Nigeria on Sunday, kill al seven passengers wey dey inside.

Nkechi Ugochukwu wey dey live close to where di crash happun say she bin dey her room wen she hear strange noise.

Nigeria Aviation Minister Hadi Sirika confam di incident say one military aircraft, King Air 350 crash for Abuja.

According to di minister, di plane crash not too far from di runway afta e report engine failure on im way to Minna.

Sirika add say di crash be like say e dey ‘fatal’ – Very serious.

Authorities don confam say seven pipo die for di crash.

Wetin remain of di military aircraft

BBC
Wetin remain of di military aircraft

‘Di plane land suddenly’

Ugochukwu tell BBC Pidgin say di incident happun close to di airport, she say she bin just dey her room for Bassa, close to di airport wen she hear di noise.

“Usually, I dey hear di sound of planes from my room as dem dey land and takeoff, but dis one own different

Di plane land suddenly and catch fire immediately. Few minutes later, two fire trucks from di airport arrive. Den anoda one land later.”

“Pipo gada, but I no see any survivors as at dat moment, na military jet crash.” She tok.

We go investigate – Airforce

Director of Public Relations and Information Headquarters Nigerian Air Force, Vice Marshal Ibikunle Daramola confam say na Nigerian Air Force (NAF) Beechcraft KingAir B350i aircraft crash while dem bin dey return to di Abuja Airport afta dem report engine failure on dia way to Minna.

Oga Daramola wey say first responders dey di scene of di accident also confam say all di seven pipo onboard die for di crash.

Oga Daramola say di Chief of Air Staff don order immediate investigation into di incident.

E also ask di general public to remain calm wait for di outcome of investigation, as dem condole with di families of di pipo wey die.