Valentine’s Day: Dating sites [Tinder, Trueflutter, Bumble] apps to find ‘love’ or val date on February 14 if you dey single

Valentine's Day: Dating sites & apps

Getty Images

Dating apps na one way to help young pipo meet someone and find date if you be single and searching.

With just few days to Valentine checkout some Dating apps and help yourself if you neva get Val date yet.

Tinder

Tinder, na one of di dating apps wey fit help you meet pipo. Users dey use left or right swipes to ‘like’ or ‘dislike’ photos of oda users wey dem go like match wit.

How to sign up for Tinder?

Valentine's Day: Dating sites & apps

Getty Images

Follow these steps:

  • Download di Tinder mobile app for your Android or iOS device
  • Na free. But e get some features wey you need to pay to use
  • You fit also login in wit Facebook, but Tinder no go post to your Facebook
  • Grant access to your device location

How to find pipo for Tinder

Once you download and join Tinder, follow these steps

  • Upload your photo for di profile screen to set up your profile
  • Tap di fire icon for di top of di screen to see feed of individuals, you fit swipe left or right
  • Swiping left mean say you know dey interested while right mean say you dey interested
  • To know more about di pesin, tap for dia profile photo

Chatting on Tinder only dey available between two users wey don swipe right for each oda photos wey dey matched.

Trueflutter

Dis na anoda matchmaking app e dey available to download for Android and IOS device dem.

Once you download and join set up your profile and you dey good to go.

Di Trueflutter app get audio becos dis one go help you hear wetin di pesin wey you dey try connect wit dey sound like even before you connect wit dem.

One of di interesting tins for dis app be say e get filters since you already know di kain spec wey you dey find di app go help you discover pipo wey go match your spec

Bumble

Na dating app way resemble Tinder wia daters go create small profile of themselves wit pictures and then swipe through for potential suitors.

  • Users fit swipe right to like profile and left to reject and wen two pipo don like each oda profile na match be dat.
  • But Bumble dey allow women to make di first move and na she go send di first message.
  • If di woman no send di first message within 24 hours of pairing she go lose di match.
  • And if she send message to a potential date and e no respond within 24 hours e go lose di match. But Bumble no dey work for Nigeria if you dey Europe and US you fit use am.
  • E dey free but e get some features wey dey app wey if you want use you pay.