Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC), don approve di use of Oxford-AstraZeneca Covid-19 vaccine for use for Nigeria.
Di Director General of di Nigerian agency, Dr Mojisola Adeyeye, wey make dis announcement say dem fit store di vaccine for 2 to 8 degree centigrade.
Madam Adeyeye say dem still dey test two oda vaccines, but Oxford-AstraZeneca own don show say di vaccine dey active against di UK version of di Covid-19 virus wey don enta Nigeria.
- All you need to know about Nigeria government 10bn Covid-19 plan for local vaccine production
- How to tell di difference between Covid-19 and Malaria
She add say, so far, dem neva see di South Africa version of di virus inside Nigeria.
Nigeria government neva tok wen di vaccine go dey available for citizens to take am.
Authorities tok say di manufacturers logistics na im delay di earlier batch of 100,000 doses wey dem dey bin expect dis month.
World Health Organisation recently approve di vaccine for emergency use.
Scientist wey do di Oxford-AstraZeneca vaccine take adenovirus wey dey for Chimpanzee come modify am so e go train di immune system to seriously fight against di SARS-CoV-2 virus wey dey cause Covid-19.