Femi Falana criticise Buhari administration afta court order CBN to unfreeze 20 End sars protesters accounts

Nigerian lawyer Femi Falana (SAN) don criticize di human rights performance of di current democratic goment, say even military dictatorship of di past no freeze pipo bank accounts.

Oga Falana say on paper Nigeria get one of di best human right laws, but di Muhammadu Buhari administration don fall di hand of twenty #EndSARS protesters after di Central Bank of Nigeria (CBN) freeze dia accounts, come give oreder make dem unfreeze am.

Falana dey react afta court order make CBN unfreeze di accounts of di End Sars protesters on Wednesday.

“Personally, e pain me because I bin dey di forefront of di big battle against military dictatorship for our kontri, and no time dey wey dem free my bank account,” Oga Falana bin tok for Channels TV programme on 11 February.

Di 62-year-old lawyer na also human right activist wey im work don receive recognition far and near like im Bernard Simon memorial award for 2003 and Defender of di year 2000 prize from di international league of human rights.

Falana claim military goment seize passports of protesters like imsef but dem dey sharpaly return dem because “di court dey convinced say we dey fight for di restoration of democracy”.

Na on Wednesday, after di 90-day period for investigation reach, ask di Central Bank of Nigeria (CBN) to unfreeze di bank accounts of 20 #EndSARS protesters.

Di judge, Ahmed Mohammed, give di order on Wednesday afta lawyer to di CBN and di legal representative of di protesters agree to end di case.

Di CBN bin freeze di bank accounts afta di #EndSARS campaign wey shake di kontri.Reports say CBN bin obtain order for November 2020, from di court to freeze di accounts wey dey some commercial banks.

Nigerian police SARS

BBC

Wetin happun for court on Wednesday?

Justice Ahmed Mohammed give di order afta di lawyer to CBN, Mr Michael Aondoakaa (SAN) withdraw di case.

Wen Wednesday, Aondoakaa tell di court say e don discuss with lawyer to di defendants and in the spirit of reconciliation, im client dey withdraw di suit.

Justice Mohammed, inside di short ruling, strike out di suit afta di application for e withdrawal.

Di apex bankbin file ex parte application on Oct. 20, 2020 to ask di court to freeze di accounts of di respondents and Justice Ahmed Mohammed bin grant am.

Dem address di court order to di head offices of Access Bank, Fidelity Bank, First Bank Nigeria, Guaranty Trust Bank, United Bank of Africa, and Zenith Bank.

Some of di accounts dem bin freeze na dat of Bolatito Oduala, Chima Ibebunjoh, Mary Kpengwa, Saadat Bibi, Bassey Israel and Wisdom Obi.

Odas be Nicholas Osazele, Ebere Idibie, Akintomide Yusuf, Uhuo Promise and Mosopefoluwa Odeseye.

Di court bin direct di banks to freeze all transactions on di accounts on ontop di list as part of CBN application as exhibit for a period of 180 days pending di outcome of investigation and inquiry by di bank.