“Lateef Jakande” – Former Lagos State Governor [Lateef Kayode Jakande] don die

Lagos first civilian Governor Lateef Kayode Jakande don die at di age of 91.

Babajide Sanwo-Olu, di current Governor of Nigeria commercial capital [Lagos] just confam Jakande death dis afternoon.

“With gratitude to God for a worthy life well spent inside di service of Lagos State, Nigeria and humanity, I announce di death of a venerable statesman, outstanding politician, public administrator and di first Civilian Governor of Lagos State, Alhaji Lateef Kayode Jakande.” Govnor Sanwo-Olu announce Thursday for im verified social media post.

Alhaji Lateef Kayode Jakande na former tori pesin alias journalist wey become Governor of Lagos State inside south west Nigeria from October 1, 1979 and December 31, 1983 wen military take ova.

Jakande later bin serve as Minister of Works under General Sani Abacha military goment.

Na 23 July, 1929 dem born Jakande AKA Baba Kekere.

Tori be say Jakande bin attract a lot of development to Lagos ontop di five cardinal programmes of im party Unity Party of Nigeria wey former Premier of the Western Region, late Chief Obafemi Awolowo bin establish.

Govnor Sanwo-Olu describe Jankande death as a great loss to Lagos State as a whole.

“Baba Jakande record of service as a journalist wey make name and a leader of remarkable achievements as govnor of Lagos State go remain a mark wey no fit clean comot for generations to come.” di siting govnor add.