BBC Pidgin Exclusive: ‘Make we stop to dey look di mata (herdsmen crisis) as security issue but as economic issue – Adamu Garba

BBC Pidgin Exclusive wit Adamu Garba

BBC
BBC Pidgin Exclusive wit Adamu Garba

One of Nigeria former presidential aspirant Adamu Garba tok say to solve di issue of herdsmen crisis, make di federal goment establish ranching as ansa.

Garba wey be IT expert follow share im thoughts on why im feel say wetin di Central Bank of Nigeria (CBN) do to cancel cryptocurrency for di kontri fit be di right move.

For exclusive interview with BBC Pidgin, self-described digital transformer tok say even as pipo dey drag Fulani pipo up and down sake of say na dem dey rear cattle and pipo dey blame dem for katakata inside di kontri, im say di tribe dey respect di law pass anybody.

‘No tribe wey respect law pass Fulani. Many attack wey dem dey do na reaction (to tins)’

You fit watch di exclusive for here:

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/videos/745943056360485/

I support wetin dem (di CBN) do ontop cryptocurrency

‘I support wetin dem (di CBN) do very well’ na so Mr Garba tok based on di new ban of cryptocurrency transactions for Nigeria wey di apex bank drop circular on February 5.

Im tok say na good move because pipo no fully understand am and pipo fit lose money despite say dis order don make plenti Nigerian both home and abroad to react, sotay Nigeria former Vice President Atiku Abubakar tok say make di CBN revise di policy.

‘Dat place (cryptocurrency), you no need to work o. If I just get once uncle wey give me like $20,000, I go just keep am dia, go dey sleep and at di end of two weeks, get money.

Which kain business be dat? Dis on na bi MMM; no be ponzi scheme?’

Im tok say even as im know say trading for cryptocurrency dey work, im tok say until big big industry put dia hand inside, di mata still dey risky.

‘Central Bank come dey tok say instead make pipo dey invest in cryptocurrency, make dem put money inside sometin wey dem go see dia investment.’

E follow tok say some jaguda pipo like drug dealers and human traffickers dey use cryptocurrency to run dia business and nobodi go know.

Na so di gist come enta how pipo fit even invest dia money for cow business.

‘Cow business no be just for Fulani’

Im tok say cow (business) no be im only business wey im dey do as e come dey compare Nigeria to oda kontris like Brazil and America as dem dey use cow business make money.

‘We sabi say Nigeria get economic problem, but no be just di goment go fix am, evribodi go get hand inside. If we depend on goment, dem no go do everitin, no go anytin.

If you invest in one cow, na three pipo go dey employed to do sometin na wey we dey call am “CowToCurrency.”‘