Silhouette Challenge: Wetin be di #SilhouetteChallenge and to do am

Nobodi dey look #BussItChallenge, now na #SilhouetteChallenge dey reign.

Even celebrities dey do am. Chloe Bailey, one half of di R&B sister group Chloe X Halle, bust pipo head wit her Silhouette Challenge wey she bin drop for Twitter.

But wetin be di Silhouette Challenge sef?

Well di Silhouette Challenge na video wey di user go dey pose sexy sexy for door side or frame before dem go sharpaly turn to black silhouette for red background.

Di hashtag #silhouettechallenge don already get pass 100 million views but nobodi know who first start di trend.

How to use di Vin Rouge filter?

You dey tink how to get di red background? Well, you gats go Snapchat and find di Vin Rouge filter for dia.

Vin Rouge filter na camera effect wey go turn your whole screen red, and leave you body to black like shadow. E go come be like say you room dey use red studio light.

For di challenge, you go first do one video of yourself as you dey stand for doorway wey go be di same body position you go start for di second video.

Wetin dey make am sweet na smooth transition.