Thomas Tuchel: Meet di man wey fit take Frank Lampard job to lead Chelsea

Thomas Tuchel

Getty Images

Thomas Tuchel don set to become Chelsea new manager afta dem sack Frank Lampard on Monday, as di club leadership dey hope say di German na di man to unlock di potential of dia most gifted talents.

Tuchel na one of di most complex manager personalities for European football. Di 47-year-old dey known as a political power player and control freak, but also as pesin wey dey tactical visionary and methodical thinker.

Paris St-Germain bin dismiss am for late December afta months full of fights between him and sporting director Leonardo.

As some pipo for France claim say Tuchel neva really bring out di best out of a star-studded squad, PSG still reach di Champions League final for August and win back-to-back domestic titles.

Im track record dey certainly good enough for Chelsea board, wey approach am shortly before dem dismiss Lampard.

At first, Tuchel bin no dey sure if to take di job midway through di season, but he don dey eye di Premier League for some time, he don first dey follow Chelsea tok for 2017 afta e comot from Borussia Dortmund.

Tuchel dey see di job for Stamford Bridge as chance to prove himself for England, just like Jurgen Klopp and Pep Guardiola – two men wey im admire – don do before him.

Thomas Tuchel with Neymar

Getty Images
Thomas Tuchel with Neymar

Who be Tuchel?

Tuchel na good communicator wit plenti ideas.

Throughout im career for senior level, Tuchel don gather experience for different environments.

He start for di small Bundesliga side Mainz, move to di much more ambitious but financially limited Borussia Dortmund and later take ova French champions

PSG.Di Blues bin get expensive footballers afta dem spend plenti money for summer but e dey unlikely say Tuchel go face di same resistance for di dressing room as e be for Paris.

Some of Chelsea players complain about lack of tactical instructions and general communication under Lampard. Tuchel, however, dey known to communicate well with im teams.

If they let am, di German go also not hesitate to implement some of im ideas – whether on di tactics board or elsewhere.

For im previous clubs, he draw up diet plans, monitor sleeping patterns of players, cancel di analytics department, change di scouting process and e dey involved for di renovation of facilities.

Thomas Tuchel

Getty Images
Tuchel no fit break Bayern Munich Bundesliga dominance but e bin lead Borussia Dortmund to di German Cup

Im repeated clashes wit management

Im willingness to control virtually everything for a club don make am enemies in di past.

During im time for Dortmund, he ban head scout Sven Mislintat, wey later work for Arsenal, from di training ground because of philosophical differences and im demand some certain signings from chief executive Hans-Joachim Watze and sporting director Michael Zorc.

“Wetin matter na fundamental values like trust and respect,” Watzke say after Tuchel don comot. “Wit Thomas Tuchel at di top, Dortmund enjoy two successful years wey dem achieve dia sporting objectives. However, we no dey always see eye-to-eye wit di coaching staff during dis period.”

Tuchel no go get di time to introduce any substantial reforms for Chelsea for di next few weeks, but di summer fit be di first test for di relationship between di German and Chelsea hierarchy. Whether owner Roman Abramovich, wey dem tok say e be fan of Tuchel, and director Marina Granovskaia go dey fond of dia manager personality na hearsay at dis point.

Tori be say, say those wey dey high up for di club believe say Tuchel go dey able to get better results out of di current squad pass Lampard, wey lose im job afta a run of five defeats for eight league games.

Di Blues don spend £222m for di transfer market last summer but most of di signings no dey meet expectations.