Ondo herders ultimatum: Presidency caution Akeredolu, Fulani community leaders

Nigeria presidency don caution Ondo state goment and di leaders of di Fulani communities for di state ontop di mata di ban on anyhow grazing wey di goment declare.

Na on Monday Ondo state govnor Rotimi Akeredolu tok say make herders vacate di forests of im state, come tok about new grazing rules.

But inside statement wey President Muhammadu Buhari spokesperson Garba Shehu release, di presidency dey follow di mata, and want make di two sides sufri-sufri.

“Di presidency don dey follow wetin dey happun for Ondo and di ‘orders’ by di goment of di state, wey ask herders to vacate di forests in seven days.”

“Wetin dey to tok, na to ask both sides to take am easy, as we urge di state goment and leadership of di Fulani communities to continue dia dialogue for better understanding, wey go bring to an end di ogbonge security challenge di state dey face.” Part of di statement tok.

Di statement also add say Govnor Rotimi Akeredolu wey be ogbonge lawyer, no go be di pesin wey go just say make thousands of herders wey don live all dia lives for di state, just comot like dat sake of say criminals don enta di forests.

Di statement add say if dis na so, di cry from rights groups,wey dey express concern over di mata go dey in line.

Dis one dey come as di National Secretary for Fulani group Miyetti Allah, Baba Othman bin tell BBC say nobody don ask dem to leave Ondo state and dia pipo wey dey di south west state no dey plan to leave. According to Miyetti Allah, wetin di govnor mean no be for dem to leave di state kpata kpata.

“Based on my discussion with our chairmo for Ondo state, wetin di govnor mean na for fulani pipo to leave unsecured bushes to dey stay wia pipo dey so dat everything go dey open.”

“Di plan na say dem wan register all di fulanis wey dey dia so dat dem go dey continue dey live dia life well, we do di same thing for Ekiti state under govnor Fayose, so no any problem.”

Di national secretary say e gist with many fulanis wey dey Ondo in di last 24 hours and none of dem dey shake.

“I feel say di reports of wetin di govnor mean no come out correctly na wetin bring dis misunderstanding, e no ask fulanis to leave im state and our pipo go continue to dey live dia.”

For some years now, Nigeria bin dey suffer from clashes between farmers and fulani pipo wey dey rear cattle, e don reach stage wey many pipo dey complain say goment suppose dey monitor di movement of fulanis in order to stop trouble.

Dis na why Nigeria goment bin comot plan to buil ruga settlement for fulanis so dat dem go stay one place.

Wetin di governor tok?

Ondo State Governor, Oluwarotimi Akeredolu, bin give seven days ultimatum to herdsmen to immediately comot from forest reserves within di state.

Di governor give dis order because of di high rate of kidnapping and crime inside di state.

E add say im administration no go fold dia arms and allow some few individuals to turn di state into home for criminals.

“Today we don take major steps to address di root cause of kidnapping, in particular, and oda bad-bad activities detailed and documented for security reports, di press and debriefings from victims of kidnap cases in Ondo State.

“Dis unfortunate incidents dey traceable to di activities of some bad elements wey dey pretend as herdsmen. Dis criminals don turn our forest reserves into hideouts for keeping victims of kidnapping, negotiating for ransom and carrying out oda criminal activities.”

Governor Akeredolu say as im be Chief Law and Security Officer of Ondo State, na im constitutional obligation to do everything lawful to protect di lives and property of all residents inside di State.

Sake of di crime wey dey happen, e issue di following orders:

  • Herdsmen need to vacate all Forest Reserves for di state within di next 7 days with effect from today, Monday 18th January, 2021.
  • Night-grazing don dey banned with immediate effect because most farm destruction dey take place for night.
  • Movement of cattle within cities and highways don dey prohibited.
  • Under-aged grazing of cattle now dey against di law

Di governor say dia decision to guarantee safety of lives and property within di State go remain di utmost as dem don direct security agencies to enforce di ban.

“Our administration go give grace period of seven days for those wey wish to carry on with dia cattle-rearing business to register with appropriate authorities.” E tok