Akeredolu news: No shaking, we dey kampke for Ondo state, Miyetti Allah reply Governor Akeredolu

National Secretary for Fulani group Miyetti Allah, Baba Othman don tell BBC say nobody don ask dem to leave Ondo state and dia pipo wey dey di south west state no dey plan to leave.

Na on Monday Ondo state govnor Rotimi Akeredolu tok say make fulani leave bushes of im state but according to Miyetti Allah, wetin di govnor mean no be for dem to leave di state kpata kpata.

“Based on my discussion with our chairmo for Ondo state, wetin di govnor mean na for fulani pipo to leave unsecured bushes to dey stay wia pipo dey so dat everything go dey open.”

“Di plan na say dem wan register all di fulanis wey dey dia so dat dem go dey continue dey live dia life well, we do di same thing for Ekiti state under govnor Fayose, so no any problem.”

Di national secretary say e gist with many fulanis wey dey Ondo in di last 24 hours and none of dem dey shake.

“I feel say di reports of wetin di govnor mean no come out correctly na wetin bring dis misunderstanding, e no ask fulanis to leave im state and our pipo go continue to dey live dia.”

For some years now, Nigeria bin dey suffer from clashes between farmers and fulani pipo wey dey rear cattle, e don reach stage wey many pipo dey complain say goment suppose dey monitor di movement of fulanis in order to stop trouble.

Dis na why Nigeria goment bin comot plan to buil ruga settlement for fulanis so dat dem go stay one place.

Wetin di governor tok?

Ondo State Governor, Oluwarotimi Akeredolu, bin give seven days ultimatum to herdsmen to immediately comot from forest reserves within di state.

Di governor give dis order because of di high rate of kidnapping and crime inside di state.

E add say im administration no go fold dia arms and allow some few individuals to turn di state into home for criminals.

“Today we don take major steps to address di root cause of kidnapping, in particular, and oda bad-bad activities detailed and documented for security reports, di press and debriefings from victims of kidnap cases in Ondo State.

“Dis unfortunate incidents dey traceable to di activities of some bad elements wey dey pretend as herdsmen. Dis criminals don turn our forest reserves into hideouts for keeping victims of kidnapping, negotiating for ransom and carrying out oda criminal activities.”

Governor Akeredolu say as im be Chief Law and Security Officer of Ondo State, na im constitutional obligation to do everything lawful to protect di lives and property of all residents inside di State.

Sake of di crime wey dey happen, e issue di following orders:

  • Herdsmen need to vacate all Forest Reserves for di state within di next 7 days with effect from today, Monday 18th January, 2021.
  • Night-grazing don dey banned with immediate effect because most farm destruction dey take place for night.
  • Movement of cattle within cities and highways don dey prohibited.
  • Under-aged grazing of cattle now dey against di law

Di governor say dia decision to guarantee safety of lives and property within di State go remain di utmost as dem don direct security agencies to enforce di ban.

“Our administration go give grace period of seven days for those wey wish to carry on with dia cattle-rearing business to register with appropriate authorities.” E tok