FG ASUU Strike update: Chris Ngige Federal Government meeting with Academic Staff Union of Universities update today

Di meeting between di federal goment delegation and di leadership Academic Staff Union of Universities, get as e be nowadays.

Both parties refuse to tell tori pipo di outcome of dia close door meeting wey happun Thursday night.

Dem bin start di meeting around 5:13 pm to find way to take resolve di nine month strike wey don ground academic activities for universities across di kontri.

Dis meeting dey come afta di two parties begin kwanta on top dia withheld salaries.

ASUU leader tell BBC Pidgin tori pesin on Friday say im no fit comment on yesterday meeting for now. Prof. Biodun Ogunyemi say im need to report to dia members first.

“We shall take back feedback from our members to government next week. Thank you.” Di ASUU National President tell BBC Pidgin.

ASUU say if goment no pay dem dia salaries dem no go resume while goment say dem don meet all ASUU demand and dat before dem go pay di lecturers, make dem resume school before dem get dia pay.

Two attempts by di two negotiating team to meet fail as dem postponed di meetings.

Background of FG/ASUU Strike meeting

For di beginning of di meeting wey hold on di 17th of December, di minister of Labour and Employment say e dey optimistic say ASUU go give am better informate on top wetin dia members don agree on top di offer wey goment don give dem.

For dia last meeting on di 27th of November, goment bin agree to pay di lecturers 70 billion Naira -30 billion for di earned allowance and 40 billion for di revatalisation moni to take equip di universities dem.

Di ASUU president for dat meeting bin say dem go cari di mata go table am before dia pipo before dem go make dia final decision.

Most ASUU members say except goment pay dem dia salaries, dem no go go back class.

Many students plus parents don dey look forward to dia last meeting but afta five hours of tok between goment and ASUU, both party leave di conference room without telling tori pipo wetin dem decide.

Dem also no release any statement on di agreement wey dem reach during di close door meeting.

E no clear why dem decide to close dia mouth on top di outcome of dia meeting and wen BBC Pidgin reach out to di ASUU president, Prof Abiodun Ogunyemi to find out wetin happun, e no response.

From di bodi language , e no clear wen ASUU go call off dia strike.

Nigerian students demand reopening of Universities wit #EndASUUStrikeNow

Afta ova 268 days wey di Academic Staff Union of Universities (ASUU) and di Nigeria federal goment don dey jam head sake of demands, university students don enta social media to call for an end to di ova eight months strike.

Wit di hashtag #EndASUUStrikeNow, students express dia dissatisfaction wit di way federal goment and di join body of Nigeria lecturers dey handle di unending strike actions.

See some of di reactions.

How di ASUU Strike start?

On 9 March 2020, ASUU begin two weeks warning strike to protests no-pay of salary to lecturers wey no follow for di federal goment Integrated Personnel and Payroll Information System (IPPIS).

Dem argue say, IPPIS no go work for lecturers becos e no consider di special way wey universities dey take operate.

Goment bin introduce di IPPIS programme to monitor transparency for di academic sector.

Why di Strike dey drag?

Goment and di union don do plenty plenty meeting to discuss di mata but each time dem dey jam rock.

As di first two weeks warning strike still dey happun, di Nigeria goment give di union conditions wey dem go take integrate UTAS wit IPPIS.

Di union begin indefinite strike afta dem reject di conditions.

On dat day, di national president of di union, Biodun Ogunyemi, accuse goment of trying to force dem to join IPPIS.

Sake of di back and forth on di payroll plan, goment get backlog of salaries of lecturers as dem no gree pay dem through di formal means.

Di mata develop into lecturers demand for payment of salaries before dem go fit go back to school.