Sim card NIN: FG order Nigeria network providers to cancel 20 Naira USSD charges for NIM SIM registration

NIM SIM Registration and Sim card NIN USSD need to dey easier and affordable, so Federal goment don order Nigeria providers to cancel N20 charges wey dem dey collect from customers.

Di Federal Ministry of Communications and Digital Economy don order all network providers to cancel di N20 charge for di retrieval of di NIN wit immediate effect.

Dr Isa Ali Pantami say make di Nigerian Communications Commission, NCC and di National Identity Management Commission, NIMC remove di 20 naira USSD fee wey dem sama subscribers for request to retrieve dia NIN.

Dis na to make di process dey easier and affordable., e add.

For inside letter wey get di informate of di directive, di Executive Vice Chairman and di Director General of NIMC tell Dr Pantami say di relevant authorities don meet wit di Mobile network operators to waive di charges.

Dis one mean say all Nigeria fit check dia NIN using di *346# for free.

FG bin ask subscribers to validate their SIm registration wit dia NIN within two weeks or dem go block dia SIM.