Wayne Rooney son Kai don sign for Manchester United- See wetin di striker tok

Wayne Rooney son don follow im father footsteps to sign for Manchester United.

Photo of Kai wey be 11 years wit im papa and mama colleen, to sign di contract for Old Trafford club.

Wayne – wey play for United from 2004 until 2017 – write for Instagram: “Proud day. Kai sign for Man Utd. Keep up di hard work son.”

Photo of Kai dey hold United shirt wit Number 10 for di back- na di same number im papa wear.

Former England international Wayne na United all-time leading scorer wit 253 goals from 559 appearances wia im win five Premier League titles, one Champions League, one Europa League, one FA Cup and three League Cups.