Omah Lay: Uganda Police arrest Nigerian singer say e disobey Covid-19 guidelines

Uganda Police don arrest popular Nigerian Singer, Omah Lay and two odas for disobeying Covid-19 guidelines.

Uganda police force confam dis report for one statement wey dia Public Relations Officer, SP Patrick Onyango bring come out today;

“Three pipo na we don arrest in connection to unauthorised concert wey dem hold last night in Ddungu Resort inside Munyonyo, Kampala City.”

“Those wey we arrest na; Ivan Ddungu, di manager of di place where di concert dey hold, Omah Lay di musician and Prim Kasana, di events Manager, wey carry Omah Lay come di kontri to sing.”

Kampala Metropolitan deputy Police tok-tok pesin, ASP Luke Owoyesigire also confam di arrest for twitter as rumours dey go round say may Omah Lay don already fly comot from di kontri since pipo no see visible evidence or images of im arrest.

Di Police say dem dey also looking for di area Officer in Charge of Police Station on top say im fail to detect di criminal acts wey happun for im area of jurisdiction.

Omah Lay bin travel go Uganda to perform for di Big Brunch event wey take place for Ddungu Resort inside Munyonyo, Kampala on Saturday 12 December.

Police say di organizers of di show disguise say dem dey do lunch and dinner event, but later on for night dem start to dey invite artistes;

“Allegation say di organizers of di show disguise am as lunch and dinner event, but later on at night dem start to invite artistes to perform.

“Di suspects dey detained for Katwe Police Station and dem go get charged with doing acts wey dey likely to cause di spread of infectious disease, wey be corona virus.”

“On di beginning of di COVID19 pandemic, di president direct say make dem stop music concerts and di directives still stands.

“We condemn di act of some selfish individuals, wey dey bent on violating di directives on CONVID-19 to make money and risks di lives of many Ugandans.”

Ugandan police force beg members of di public to obey di Ministry of Health guidelines on coronavirus.

Meanwhile, #freeOmahLay don dey trend for social media as fans of di artist dey react to di news of im arrest.