Lagos bye-election 2020 – Movement restriction for local governments under Lagos east senatorial district on Saturday go last from morning till evening

Lagos state police command don exempt candidates wey dey write the West Africa Examination Council examination, WAEC and dia officials from the restriction of movement order.

For statement, di police tok say all Waec staff go need to flash dia staff ID card, supervisors go show dia Waec appointment letter or ID card and examination mail bags.

As for candidates, dem go show dia photo cards wey get dia names, passports and subject details to take identify demselves.

Police for Lagos State Nigeria don restrict movement for five local goment areas wia senatorial and house of assembly election go hold on Saturday.

Di Saturday by-election na to fill di vacancy for di Senate from di Lagos East Senatorial district and Kosofe Constituency II House of Assembly by-elections.

Di restriction go begin from 6am to 6pm.

Di local goments wey dey affected na Epe, Ibeju Lekki, Kosofe, Somolu and Ikorodu.

Dis one mean say pipo no go fit pass through dis local goments to anoda area while travelling. Motor no go fit pass.

Sake of di election, police don deploy plenti officers to di 1,928 polling units wey di election go hold.

Only pipo wey dey essential duties go fit move around during dis period. Odas wey get clearance to move na election officials and observers.

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/posts/1689495194589533

Lagos By-election

Di By-election go hold for Lagos east senatorial zone to replace vacant seat wey senator Adebayo Osinowo make open following im death for June dis year.

By-election na election wey dey hold to put pesin for vacant seat outside di normal election period.

Mr Tokunbo Abiru of di APC and Mr Babatunde Gbadamosi of di PDP na di major contenders for di election.

Dis election go affect five local goment areas LGA’sand eleven local council development areas LCDA’s.

INEC say 1,168,790 voters go follow vote for di election wey dem reschedule from October to December 5.