Boko Haram attack: Borno Governor Babagana Zulum say pipo dey sabotage FG insurgency fight afta farmers ‘massacre’ for Koshebe

Zulum

Getty Images

Govnor of Borno State Prof Babagana Zulum say di Nigeria fight against insurgents like Boko Haram no go end until di federal goment deal wit sabotage and corruption.

Oga Zulum tell BBC Pidgin dis one on Monday following di killing of at least 34 farmers by members of Boko Haram on Saturday 28 November.

Di killing happen for Koshebe village, for Mafa local govment area, inside north-eastern state of Borno, wia according to Zulum, na one stronghold of Boko Haram militants.

“Pipo no understand when I tok dis tins, dem go say I dey try condemn di military but plenty sabotage dey di system! Sabotage dey within di politicians, sabotage dey within di Nigerian military, sabotage dey within di civil servants.

Whoever dey responsible for dis crisis, dem suppose deal with am well-well. Na wetin we need be dis,” 51 year-old govnor tok.

No be today Oga Zulum don comot to criticize di Nigerian Army say dem no do enough to epp protect lives and property for im state, although im refuse to put di blame on di Saturday ‘Koshebe massacre’ for di domot of di Army.

Burial of pesin wey die during insurgency attack on di convoy of Gov Zulum for Borno - 26 September 2020

Getty Images
For September suspected militants fire heavy guns and missile ontop di convoy of Gov Zulum; E survive although some of im security (policemen) die

How di ‘massacre’ take happun?

Oga Zulum confam say on Saturday militants wey dem suspect to be from Boko Haram arrive for one rice farm for Koshebe, wey be plantation area.

Many of di farmers come from Zabarmari, wey be anoda neighbour town and normally farmers go spend two to three days for Koshebe town to farm before dem return to dia house.

Di farmers bin first tink say di attackers mean well for dem, based on how di militants – wey no carry guns – explain say na preach dem wan preach to dem.

Next tin be say dem put dem inside one house, only to begin bring dem outside one by one, to slaughter dem “like cow”.

Di first time govnor confam say women and pikin no dey among di 34 men wey die, although e say 13 pipo escape.

E expect say di number of death go increase as di community identify and bring more bodies for burial.

On weda di attackers kidnap some pipo go, di govnor say e no believe say dat kain tin happun.

“Nobody don tok anytin about abduction, wetin dem do worse pass to kidnap. Wetin dem come do na to kill anyhow!”

Temporary house wey IOM (International Organization for Migration) build inside Borno Internally Displaced Camps (IDP)

Getty Images
Zulum say prostitution, child abuse don dey rise in Borno IDP camps as pipo no get anywia to go, or see anytin to do

Boko Haram dey recruit pipo from IDP camps

Insurgency attacks don drive thousands comot dia homes for Borno State, wey for many years na di stronghold for Boko Haram. In fact di mata worse between 2011 to 2015.

“Before 8am, at least four to five bomb blasts go don happun, wey four hundred, five hundred pipo go die inside. Almost 1000 pipo die in one day… for 2013,” Zulum bin recall as im compare current times to some years ago.

Although di former university professor believe say attacks no plenty for im state like before, he imsef no fit deny di social and economic impact wey Boko Haram attacks don put residents of Borno for.

Inside di Monday exclusive interview wit BBC Pidgin, Oga Zulum say federal goment need to act fast, because Boko Haram don dey find way to recruit young pipo from IDP camps, wia dem keep pipo wey attacks don chase comot dia house.

E also claim prostitution, child abuse don rise inside di IDP camps. Ontop of dat pipo dey starve, and dem no fit farm.

Di UN say about 1.9 million pipo na im dey displaced for Borno, Adamawa and Yobe states – sixty percent of dem na children.