Uhuru Kenyatta: Kenya president explain why e dey close down im personal twitter account

Kenya President Uhuru Kenyatta

Getty Images

Kenya President Uhuru Kenyatta don close im personal Twitter.

Oga Kenyatta on Wednesday explain say im close di account sake of insults.

E say di insults on Twitter dey always vex am and im no dey fit sleep.

“I go rather tok to my wife, sleep and wake up for morning to work,” he tok for Swahili.

Di head of state’s personal twitter account get more dan three million followers but e don deactivate am and im administration now dey use State House account, wey get around one million followers.

Goment communication team no for any time tok di reason why di President account no dey active.

Kenyans on Twitter dey very active on Twitter as na one platform dem dey use express themselves and e dey sometimes lead to online fights wit tweeters from other countries.