CNN report on Lekki toll gate shooting: Lai Mohammed reply TV station report on End SARS killing

Lai Mohammed

Getty Images
Lai Mohammed na Nigeria information minister

Di Minister of culture and information, Lai Mohammed don respond to CNN report on top di Lekki shooting during di End Sars protest against police brutality for Lagos last month.

Di minister say tori pipo for CNN no carry out responsible journalism say dem dey misinformate pipo based on dia report.

CNN bin do documentary to show how di Nigerian Army shoot live bullets on protesters wey gada for di Lekki toll gate, although di Nigerian Army don deny say na bland bullets dem shoot and na into di air.

CNN say dem use confam video footages wey get time and date and data, testimony from plenty eye witnesses wey dem interview and forensic examination of video and dozens of fotos wey pipo capture before, during and afta di Lekki toll gate incident.

Wetin oga Lai tok?

Oga Mohammed discredit di report of di media organisation.

“CNN no get reporters on ground during di Lekki toll gate protest, dem rely on videos wey dey circulate on top social media.

“On which basis dem do dia report?”, di minister ask.

He also add say, why tori pipo for CNN no balance dia tori? e say why dem no use di report of di Military oga, Gen Taiwo wey im present for di Lagos judiciary panel wey dem set up to chook eye for wetin really happun during di Lekki End Sars protest.

E say dem suppose sanction CNN for dia report as dem bin tweet before say 38 pipo die but later change mouth to tok say na only one pesin die.

“Before deployment, we brief soldiers on wetin dem go do.

Dem only fire blank ammunition and blank ammunition no fit damage di flesh or kill pipo.

If dem really fire live ammunitions, plenty pipo for die but dat no happun.

Fake news deceive di whole world and nobody don come out to say dem lose dia pikin or relatives for Lekki toll gate.” Di Minister tok.

E also add say, If anybody get any case, make dem come out and present am before di panel wey we don set up instead wey dem dey call for sanction against di kontri.

E say Federal goment dey satisfied wit di operation wey di military carry out during di End Sars protest for Lagos.

Wetin di CNN documentary reveal about di Lekki toll gate shooting?

  • Di video show how army trucks leave di Bonny Camp barracks for Victoria Island at 6:19 and head towards di toll gate plaza and the protesters.
  • Dem say army begin shoot at 6:43 until at least 8:24pm.
  • Dem interview plenty eye witnesses and families of dos wey lose dia loved ones to di Lekki shooting and dem confam say army bin shoot at di protesters and clear body of dos wey die.
  • Dem say pipo wey injure for di protest begin reach hospitals by 7:19pm.
  • CNN bin check bullet casings wey dem find for di scene of di incident and dem confam say di bullets match wetin di army dey use. Two ballistics experts also confam give CNN say di shape of di bullet casings show say dem use live rounds.
  • Di media organization work wit di Balkan Investigative Reporting Network and dem confam say most of di bullets dem see for di Lekki toll gate come from Serbia. Experts documents wey CNN see show say Nigeria buy weapons from Serbia almost every year between 2005 and 2016.
  • CNN report say no be only Army shoot dat night, say even police join sef.