NYSC portal: Guidelines Prospective Corp members must do before dem enta camp

Di Presidential Task Force on Covid- 19 and di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say all National Youth Service Corp members must do compulsory Covid- 19 test wen dem reach orientation camps and only dos wey carry test result wey be negative go dey allowed to enta camp do registration.

Dis na part of di guidelines NYSC, PTFCovid- 19 and di NCDC bin develop to make sure 2020 NYSC orientation camp activities for across di kontri dey safe for prospective corp members wey go enta camp on 10 November, 2020.

Nigeria President Muhammadu Buhari also direct di National Youth Service Corp to make sure say di agency enrol all corp members for di National Health Insurance Scheme.

Di Director-General of NYSC, Brigadier-General Shuaibu Ibrahim wey give dis informate say dem dey work wit security agencies to make sure say corp members dey safe for anywhere dem dey serve for di kontri.

Tori wey we dey hear na say di Covid- 19 test go dey free and NCDC officials wey go conduct di test don already dey di orientation camps across di kontri.

Other guidelines to ensure safety for orientation camps na:

  • Dem go add more orientation camps to each state to reduce di number of pipo wey go dey camp. Dis na make social distancing for dey.
  • All orientation camps go dey fumigated before dem open dem.
  • Compulsory temperature screening o dey for every camp entrance.
  • Use of face mask go dey compulsory for all corpers, camp officials and visitors.
  • Beds for di hostel go allow for 2 meters spacing.
  • All corp members go need fill di COVID-19 testing self reporting form before dem go fit download dia call up letters.
  • Plenty pipo no go gada together to take part for each orientation exercise.
  • Hand hygiene stations go dey for strategic locations for di camp
  • Plenty sensitization go dey on di safety protocols.