EndSARS Protests: [Did anonymous hack Airtel?] See sites Anonymous don claim to hack for Nigeria

As Nigerians dey protest ontop di End SARS – Special Anti-Robbery Squad and for di end to police brutality for street and social media, one group of hackers wey dem call Anonymous don cari di protest go hacking.

Na last week, dem bin give Nigerian goment 72 hours to attend to di demands of di [End SARS] protesters or dem go start hacking campaign.

On Sunday, di group list di sites of di Nigerian goment wey dem dey plan to attack.

Dem bin also claim to reveal di phone numbers and email address dem of goment officials including President Muhammadu Buhari.

Dis na some of di sites wey dem don claim to hack

Central Bank of Nigeria

Di collective Anonymous bin claim on Friday say dem take di Nigeria Central Bank [CBN] offline.

In fact dem claim say dem leak 3500 emails from di kontri central bank.

However, CBN comot with statement to clear di mata say dia system dey secure.

Nigerian Stock Exchange

Anonymous on Monday claim say dem enta di Nigerian Stock Exchange [NSE] dia website,

But di agency, tok for dia Twitter page, say di claim dey without foundation.

But report wey BBC Pidgin find out show say e belike say hackers bin access di back end alias admin panel of di kontri stock exchange website.

“Di Administrator application, wey also dey known as di Back-end, Admin Panel or Control Panel, na di interface wia administrators and oda site officials wey get access fit manipulate di look of di NSE web site.”

Association of National Accountants of Nigeria

On Monday, Anonymous claim say dem hack di website of professional join bodi Association of National Accountants of Nigeria to deface am.

Banks (First Bank of Nigeria and Access Bank)

Anonymous tok say dem take down di websites of two Nigerian commercial banks to show those wey dem call haters say dem get di power.

However, dem clear Nigerians doubt say dat one no mean say dem go begin dey share di money.

But First Bank dey claim say dem neva hack dia website.

Airtel

Di same day, Anonymous announce for social media say dem share one thousand Naira for Airtel subscribers.

And plenti pipo enta social media to confam di mata although [Airtel] di Nigerian mobile telecommunication company neva tok anytin.

BBC Pidgin find out say by Monday night, Airtel reverse di account balance for some subscribers wey benefit from di hack claim.

Nigeria Centre for Disease Control

Anonymous claim responsibility say dem cari di Nigeria Center for Disease Control [NCDC] go offline and identify pipo wey dey di site.

Sotey dem reveal all di emails for inside di website on Sunday.

Nigeria Army

According to di group, dem claim say dem don cari di Nigerian Army website go offline three times now.

Dis dey come as Nigerians dey fear say di Crocodile Smile exercise di army dey plan na sake of di End Sars protests.