
Nigerian Army don announce say dem go conduct di first ever Cyberwarfare exercise for Africa from 20th October.
Di Acting Director Army Public Relations, Colonel Sagir Musa for inside statement tok say dis go dey part of di annual Crocodile Smile exercise wey di Army go use find, track and counter negative propaganda for social media and across cyber space.
Dis na di first ever Cyberwarfare exercise wey go happun for di history of African Armed Forces.
- See five important facts about new SWAT police team
- States don begin set up Panel of Inquiry into Police Brutality and Extrajudicial killings – See wetin you need to know
Di Army tok tok pesin say di exercise go include positive identification method wey dem go take sabi Boko Haram terrorists wey dey run comot from di North East and from oda parts of di kontri.
Di Crocodile Smile VI Exercise go start for all part of di kontri for 20 October and end for 31 December 2020.