Baruwa gas explosion in Lagos kill eight pipo and destroy more dan 20 houses

Eight pipo don die and several odas injure for di gas explosion wey happun for Baruwa area for Lagos state south west of Nigeria according to authorities.

Di fire start around 6am dis morning according to authorities but dem no give any further details about di incident.

Dem say dem no know wetin cause di explosion for now.

According to dem members from Tiger team, Dolphin team, LRU Fire, LASG Fire Service, NPF, NUPENG, and LNSC dey on ground to stop di spread of di fire to oda building.

Some pipo wey dey leave for di area don begin post videos of di incident for social media.

Dis dey happun few weeks afta di Iju-Ishaga explosion wey injure at least 30 pipo for September.

20 Adults male and 10 adults female na im wound, e destroy one market for Iju-Shaga as 15 shanty shops burn down, according to rescue officials for Lagos.

At least 23 buildings and 15 vehicles, wey include 11 Cars, two mini trucks, one bus and one heavy duty truck, na im di explosion burn down.

Na LP Gas tank truck fire for Ifako-Ijaiye cause di Iju-Ishaga gas explosion.

See di tins wey di gas explosion affect

Buildings

  • 25 houses, mostly bungalows
  • 16 lockup shops
  • 1 primary school

Vehicles :

  • Gas tanker truck (1
  • Pick up van (1)
  • Tricycle (1)

See fotos from di incident