“Unity Schools meaning”, October 12 “FG resumption date for schools” and universities reopening update in Nigeria

Nigerian goment don order di re-opening of all federal goment owned universities immediately and unity schools from 12 October, 2020.

Minister of Education, Mister Adamu Adamu announce on Friday for im office for Abuja say dis reopening order na sake of say covid-19 infection rate for Nigeria don dey go down.

Aside unity schools, all universities across di kontri don get green light to also open.

National Universities Commission (NUC) bin release new directives to Vice-Chancellors of Nigerian universities on how dem go safely reopen schools.

Di tok tok pesin for Nigeria University Commission, Ibrahim Yakasai say di commission don ask all universities make dem open as long as dem meet di covid 19 protocol.

Di NUC for one memo wey e write give all Vice-Chancellors as dem make dem conclude all dia arrangement to open school.

Di tok tok pesin for di commission wey present di memo to BBC Pidgin say all universities now fit open since covid 19 case don drop for di kontri.

For inside di memo NUC explain give say; ” following di recent briefing by di Presidential Task Force Team on COVID – 19, and di fact say covid 19 don reduce, di Federal Ministry of Education don accept di request of di National Universities Commission for Universities to conclude dia arrangement to immediately resume academic activities”.

Di NUC say make all universities dey expect say dem go visit dem to chook eye on top weda dem dey follow di guideline wey dem give dem.

E further explain say staff of di commission plus those from di ministry of Education na dem go do di on-di -spot inspections of physical facilities wey be lecture theatres, accommodation, healthcare facilities.

Oga Ibrahim Yakasai say make universities no violate di cycle of di semester system as approved by NUC.

"FG resumption date for schools" and universities reopening update in Nigeria

BBC
NUC memo on universities reopening update in Nigeria
"FG resumption date for schools" and universities reopening update in Nigeria

BBC
NUC memo on universities reopening update in Nigeria

E say all di universities must continue to follow all di safety protocols and the NCDC guidelines.

E explain give say di commission don already issue memo give all di universities dem to ask dem make dem dey ready to open and dat every university fit open whenever dem dey ready.

Oga Ibrahim further explain give say di NUC don already begin go from state to state to inspect some universities wey don open and at di moment, dem dey Lagos state.

E say both private and goment universities don get greenlight to open for business.

E also explain give say schools for di 36 states of the federation dey at liberty to fix resumption dates and dem must make sure say dem put adequate safety measures in place.

E say goment meet wit all di relevant stakeholders for di education sector including Association of Private School Owners, National Association of Proprietors of Private Schools, Provost of Colleges of Education, Rectors of Polytechnics, Vice Chancellors if Universities, state govnors, development partners, state commissioners of education and international organisations before dem come dia earlier decision to open school.

Di minister say so far since dem open school for di exit classes, nobodi don get coronavirus for all di 104 unity colleges across di kontri and dat di isolated case wey dem get for oda schools no plenti and nobody don die for di schools.

E further yarn say di goment di work make e open learning facilities nationwide and e beg owner of schools make dem put in place system wey meet di following guideline:

  • Safe distancing procedure must dey in place
  • Develop and display at school all di day to day actions wey students gatz follow
  • Di schools gatz conduct risks assessment to find out wetin fit cause any form of transmission
  • Dem also need to ake sure dem put in place beta hygiene for all stages of di school reopening
  • Ensure say dem get adequate water and sanitation facilities across di school premises
  • Make sure say dem use open spaces for gathering
  • Establish staff/ student committee for regular surveillance

Di minister further cut warning give say any school wey no follow dis protocol and come allow any coronavirus outbreak, dem go close di school down.

“Unity Schools meaning”

Unity schools na all di Federal Goment Secondary School and each 36 states for di kontri get one or two unity schools except for Lagos state wey get three.

Shortly afta independence for 1960, di federal goment under di leadership of Prime Minister, Abubakar, Tafawa Balewa realise say kontri pipo bin no trust each oda sake of say dem no each oda well.

So for 1966, di goment come decide to establish inter regional secondary schools and later call am Federal Goment Colleges for di three regions East, North and West.

Dem bin build di schools dem to foster national unity and cohesion and bring pupils from different part of di kontri togeda for one school and also to prepare dem well well for dia senior exams dem.

Di first unity schools bin dey establish for Okposi for east, Sokoto for north and Warri for West but for 1970 sake of di performance of di school pikin dem, di den head of state, Yakubu Gowon come decide to expand di schools dem to oda states

E increase di schools from three to 12 and from dia di schools begin expand and now di kontri get 104 unity schools.