NLC suspends strike: Nigerian Labour Congress strike update and outcome of meeting dem hold wit FG

Nigeria Labour Congress (NLC) strike wey suppose start on Monday dey suspended following di outcome of meeting NLC hold wit federal goment.

Tori be say federal goment bin enta meeting on Sunday evening wit labour leaders in order to avoid a shut down of di kontri work force sake NLC demand.

Nigeria Labour Congress wey be join bodi of public workers for Nigeria bin dey prepare to start strike action plus protest on Monday 28 September sake of how goment increase of petrol price and electricity tariff moni happun for di same time all over di kontri.

Wetin be di outcome of meeting NLC hold wit federal goment?

Federal goment and Labour reach agreement at 2:53am afta hours of meeting, according to Festus Keyamo, Nigeria Minister of State for Labour & Employment.

One of di things dem agree be say di deregulation (market control of petroleum pump price) go remain as goment roll out support moni alias palliatives for labour (details in 2 weeks).

Also electricity tariffs (wey goment increase from 1 September, 2020) go dey suspended by goment for 2 weeks wit a joint committee wey Oga Keyamo go head to look into alias examine di main reason or justification for di new policy. Strike suspended

NLC President, Comrade Ayuba Wabba, Trade Union Congress (TUC) President Quadri Olalaye, NLC Secretary General Emmanuel Ugboaja, TUC Secretary General Musa Lawal Ozigi, NUPENG President Williams Akporeha, PENGASSAN President Festus Osifo, President of NUEE MartinUzeogwu, President of SSAEAC Chris Okonkwo na im join hands sign di agreement on behalf of labour unions wey suspend di strike.

While Minister of Petroleum, Timipri Silva, Minister of Labour and Employment Chris Ngige, Minister of State for Labour & Employment Festus Keyamo, Minister of Information Lai Mohammed, Minister of State for Power Jedy Agba and Secretary to di Goment of di Federation Boss Mustapha na im join hands sign on behalf of Nigeria federal goment.

Wetin NLC dey demand from federal goment wey make dem wan strike?

NLC President, Comrade Ayuba Wabba say dem want goment to return back to di way prices of electricity tariff and petrol pump price bin dey before.

Afta di meeting, federal post details of wetin dem agree wit labour for dia twitter post.

NLC Suspends strike

BBC

Watch dis video:

Electricity tariff
The British Broadcasting Corporation