All di Big Brother Naija Season 5 lockdown housemates, both di ones dem evict and di top five wey still remain for di house meet on Saturday night to party togeda for di last time.
Na tin of surprise for di remaining housemates, Neo, Vee, Nengi, Dorathy and Laycon bin no know say di evicted housemates dem go show as biggie use am take surprise dem.
- See wetin housemates don win so far for BBNaija season 5
- Fans react to BBNaija Laycon ‘revelation’ say im Genotype na SC
In case you miss di show, check out di top five tins wey go down for di party.
Erica no show
All evicted housemates, Ka3na, Lilo, Eric, Tochi, Kaisha, Wathoni, Lucy, Praise, Trikytee, Tolanibaj, Brighto, Kiddwaya, Prince and Ozo show for di party except Erica wey Biggie bin disqualify because she break di house rules.
All white party
Di party dress code na all white. All di housemates both evicted and di top five all wear white.
E no end dia. Some of di evicted housemates give pipo something to tok about with dia ogbonge dressing.
Laycon even confirmed it “Lilo looks like a queen” Truly she deserves that royalty tonight. 💯🔥 pic.twitter.com/v5BPv8Pxie
— Official_Gold. (@freshgold16) September 26, 2020
For the #BBNaija all white party,
Best dressed female- Lilo
Best dressed male- Prince
Rt if you agree 👍 pic.twitter.com/O3XfB9vvjz— Popcorn ❤ #BBNaija (@insidelaff) September 26, 2020
Prince, Ka3na and Lilo are the best dressed tonight 🔥🔥🥺
That’s the entire tweet #Bbnaija pic.twitter.com/kU2Ors6VkR
— DANNY WALTER👑🎠 #ShoePlug (@DannyWalta) September 26, 2020
Prince give pipo plenty to tok about with im ogbonge dressing. E first dressing with im signature durag and second shirt and beanie e change to during di party.
It’s PRINCE night y’all!! BEST DRESSED YUUURRR!!!! 🔥🔥🔥🔥🔥🥵🥵🥵🥵🥵🥵 pic.twitter.com/SrPG43xOpr
— Chi 🍫 (@TOBEA_1) September 26, 2020
Reunion?
Oh well pipo bin no sure how dis reunion go be like wen Biggie tok say di ex-housemates go show, until time for di party wen we see say dem demarcate di ex-housemates from di remaining housemates.
Na Laycon first show for di party and e no fit hold imsef as im begin dey hala dey hail all di ex-housemates before di rest come out.
Pipo bin dey also watch out to see how Ozo and Nengi go relate for instance but notin like dat.
Wetin we see na most of di ex-housemates dey do dia tin for dia side while di remaining housemates dey dia own side of cos maybe because of di demarcation wey biggie put up.
Infact Nengi later cry afta di party say Ozo ignore her and no gree tok to her during di party.
600 years for who made Ozo “ignore” Nengi😭😭😭
🤣🤣🤣
What’s that thing they say about “first to do” again?#BBNaijaLockdown#AllWhiteParty pic.twitter.com/0ahO8GdDod
— DStv Nigeria (@DStvNg) September 26, 2020
Music
Finally wetin be party without music?
Some fans hail di DJ of di night, DJ Neptune say e try and also di live band.
Musician Praise also make surprise appearance and even manage to make Ka3na and Neo shed some tears with im ogbonge performance.