Coronavirus Vaccine: WHO don agree for rules to test African Coronavirus herbal remedies

WHO, Geneva

AFP

Di World Health Organisation don agree rules for di testing of African herbal remedies to fight Covid- nineteen.

WHO regional office for Brazzaville tok say dem don endorse one protocol for clinical trials.

Any traditional remedies wey dem judge say e dey safe and effective dem fit begin sharpely-sharpely manufacture am plenti.

Di agency tok say sound science na di sole basis for safe and effective traditional therapies.

Dem add say di purpose of di new rules na to help and empowering scientists inside Africa to conduct proper clinical trials.

Before now, di president of Madagascar, Andry Rajoelina bin dey promote one plant-based drink wey WHO neva test and e dey claim say e fit stop di virus.

Di main ingredient for dis Madagascar plant-based drink na, artemisia, wey report say dey effective for di treatment of malaria but no evidence so far if e fit fight Covid-19, according to World Health Organization.

WHO announcement dey come as di number of confam cases of coronavirus worldwide don pass 30 million, with reported global deaths standing at more than 957,000.

For Africa, dem don record more than 1.3 million cases of di virus and more than 33,000 reported deaths

Around 140 potential vaccines for Covid-19 na im dem dey develop around di world, with dozens already wey dem don test on pipo for clinical trials.