Self-Certification Form: Nigeria goment apologise for tweet wey say make bank account holders and oda financial institutions go fill form

Muhammadu Buhari

Getty Images

Nigeria goment don apologise afta dem announce on Thursday say make all Nigerians wey get accounts wit banks, insurance companies or any oda financial institutions go collect, fill and submit one Self-Certification Forms to dia respective institutions.

Di goment bin make dis announcement on Thursday for dia official twitter account say di self-certification form dey important to epp financial institutions follow correct procedures for any mata wey concern Income Tax Regulations 2019.

But dem later delete di tweet.

Before dem delete di tweet, di announcement bin no go down well with pipo wey come out to speak dia mind.

But goment don come out to clarify say di form no be for everybody but for some category of bank account holders for di kontri.

See di three categories of di self-certification form

Di self-certification form go dey in three categories according to goment.

– Form for Entity

– For Controlling Person (Individuals wey get controlling interest for legal person, trustee, etc)

– Form for individual

Goment say failure to do dis go attract punishment as di pesin fit lose im money or im fit no fit use di account again.