Edo Governorship election 2020: Timeline of di battle to lead di state from 2019 and wia e dey now

Godwin Obaseki and Osagie Ize-Iyamu

BBC

As Edo govnorship election don near finish, and di two big political parties dey campaign seriously to win di votes and hearts of di pipo.

Two candidates na im all eyes dey on to see who go las las win di election. Govnor Godwin Obaseki and Pastor Osagie Ize-Iyamu.

Di journey to today no be smooth one as di Edo and indeed Nigeria don witness some kain drama between di two main parties wey dey context for di election and dia candidates, di Peoples Democratic Party candidate (PDP) wey be di current govnor of di state, Godwin Obaseki and di All Progressives Congress (APC) candidate Pastor Osagie Ize-Iyamu.

Pesin fit tok say di drama begin right after Godwin Obaseki – of den APC – become govnor of di state, to replace who many bin believe to be im godfather at dat time – Adams Oshiomhole.

Until Obaseki later resign from APC, di ruling party bin dey control 21 states while opposition PDP bin dey im charge of 15 states.

Make we look back to how di palava start.

17 June 2019

Shock as pipo wake up to hear say Edo House of Assembly don inaugurate nine of dia 24 members secretly.

Tori be say dis quick move na to prevent Oshiomhole supporters not to get mouth for running of tins for di state.

“Edo own na 9.30 pm, wey be unholy hours. Dat na night hours. Di working hours for parliament dey inside di rules of di parliament. E no dey for any pesin hand to change those rules only properly constituted parliament fit change di rules as dem dey,” Oshiomhole bin tok some days later on 22 June.

4 July 2019

Govnor Obaseki sack eight commissioners. Tori be say dis na pipo wey dey loyal to di den APC National Chairman Oshiomhole

12 September 2019

Afta one panel wey National Assembly bin don setup to torchlight mata for Edo, one Federal High Court chook mouth for di mata and order di National Assembly to comot hand for di state.

21 November 219

Pastor Osagie Ize-Iyamu, wey be governorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) for di 2016 election announce say im don port go APC, di ruling party.

5 March 2020

One Abuja High Court stamp di suspension of Oshiomhole say make e hold since di Edo State chapter of im own party still put am on suspension, wey im appeal di next day.

Election ballot box

Getty Images

12 June 2020

In wetin go be di month wey get drama pass for di Edo crisis, June na di one time Obaseki imsef begin see wehn!

Dem disqualify Obaseki on di basis say im certificate im submit for school no pure.

16 June 2020

One court for Abuja rule say Oshiomhole appeal no hold water and im suspension must remain.

– Later on di same day, APC appoint Abiola Ajimobi to replace Oshiomhole as National Chairmo.

– Obaseki defect from APC, di ruling party to PDP, as rumours begin fly say im don join new party.

19 June 2020

Days afta e comot APC, im announce say im dey renew im bid to run for di state govnorship under PDP ticket.

6 August 2020

Gov Obaseki give order say make dem comot roof of di House of Assembly. Many believe say dis move na so that lawmakers no go fit do sitting for di building.

But di assembly building bin dey under renovation.

Edo State House of Assembly

BBC

7 August 2020

President Muhammadu Buhari endorse Osagie Ize-Iyamu in di place of im ‘friend’ Obaseki.

Dis dey come just two months afta Pastor Ize-Iyamu port comot from di kontri main opposition Peoples Democratic Party (PDP) to join di ruling APC for di southern state of Edo.

1 September 2020

Convoy wey Oshiomhole dey inside been get accident wey claim di lives of two policemen. Di former APC national chairman imsef survive.

Ize-Iyamu inside message for Twitter allege say based on how one big truck take jam di convoy, e reason am say di accident na attack to take di life of Oshiomhole.


But everitin no be fight with dis big players for Edo State, because even with kwanta, when tori comot say Oshiomhole get road accident, na Obaseki still comot public message to wish am well.