Daddy Freeze and David Ibiyeomie: Di OAP respond to warning from di pastor say im insult Bishop Oyedepo

Daddy Freeze wey im real name na Ifedayo Olarinde don tok say im no insult di founder and Bishop of di Living Faith church, David Oyedepo.

For video wey im share for im Youtube page, di Nigerian On Air Personality wey dey popular for im criticism of di church say wetin im do na to correct Bishop Oyedepo scripturally.

“He quote from di book of Ephesians chapter 5 vs 22 and I draw im attention to verse 21”, Daddy Freeze tok.

“To correct pesin scripturally no be insult”, e add am.

Pastor David Ibiyomie wey be founder and senior pastor of Salvation Ministries bin call out Daddy Freeze say im dey insult Bishop Oyedepo.

For inside video, di senior pastor tok say im no fit allow Daddy Freeze insult im ‘father’ wen im dey alive.

“Tell Daddy Freeze, di day I hear am tok about Bishop Oyedepo again, If I no finish am….”, He tok for inside di video.

Di OAP say im go like draw di attention of di public and law enforcement to di ‘threat of life’ wey Pastor Ibiyomie issue to am for day video.

He tok say if anything happun to am, make dem hold Pastor Ibiyomie accountable.

Wetin really happun?

Bishop Oyedepo bin share one post on im Instagram handle wey say, ”Di only way to fruitful marriage na total submission for di part of di wife.”

“Until e dey in place, every oda thing she try to do go dey out of place. Woman wey no gree submit to her husband dey disobey God.”

Daddy Freeze, react to Oydepo post for im instagram page.

He tok, ”Di fact say pesin don marry for 30 years no mean say im be expert on marriage mata.”

For inside di ova 45 minutes video, he add am say ”Many religious marriages na endure dem endure dem no dey enjoy am. Many pastors dey suffer in silence.”

Dis no be di first time wey di On Air Personality don criticise Nigerian pastors and dia stance on faith. He start im ‘Free the Sheeple’ for 2017 to disagree wit di principle of paying tithe to Church.